Levitikus 27
27
Vow Wey Pesin Make
1God tell Moses: 2“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen man don give ensef to God to take fulfil di special vow wey e make, di pesin go dey free afta e don pay dis money, 3bikos man wey bi from twenty years go rish sixty years, na fifty shekel e go pay akordin to di shekel wey dem dey take for di temple. 4If di pesin na woman, na thirty shekel e go pay. 5If di pesin na from five years go rish twenty years; for man, na twenty shekel and for woman, na ten shekel e go pay. 6If di pesin na from one mont go rish five years; for man, na five shekel and for woman; na three shekel e go pay. 7If di pesin na from sixty years go up, if na man, na fifteen shekel and woman, na ten shekel e go pay. 8If e nor get money take pay en vow, e must take di pesin to di priest and di priest go reduce di money, akordin to wetin di pesin go fit pay.
Animal Vow
9“ ‘If na animal e vow sey e go give God as ofrin, den anytin wey e give to God from dis animal go dey holy. 10And anybody wey make dis vow, nor go use anoda animal take replace am, weda na good for bad or bad for good. If e go use anoda animal, den di normal one and di ones wey e shange am to, go dey holy. 11If wetin e vow na animal wey nor klean; wey e nor go fit give as ofrin to God, den e go make di animal stand before di priest, 12di priest go kon fix prize for am, weda e good or bad and na di prize wey di priest tok, go bi di final prize. 13If di pesin won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
House Vow
14“ ‘Wen pesin dedikate en house to God, di priest go fix di prize weda e good or bad and di prize go bi di final prize. 15If di pesin wey dedikate di house won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
Land Vow
16“ ‘If anybody dedikate one part of en field to God, di priest go fix di prize akordin to di nomba of seed wey dem go fit plant and e go bi ten silva for evry twenty kilogram for barley. 17If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize. 18If e dedikate am leta, di priest go kakulate di money akordin to di years wey remain before di next Sabat year, den e go reduce di prize. 19If di pesin wey dedikate di field won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join. 20If dem sell di field give anoda pesin, e nor go fit buy am back. 21For di year wey dem dey free pipol, di field go kon bi God own forever; so e go kon bi di priest own. 22If anybody dedikate field wey dem buy give God, 23di priest go kakulate di money akordin to di nomba of years wey remain before di next Sabat year and di pesin must pay di money for dat same day; na God get di money. 24Dem go give di field back to di pesin wey really get am or en shidren-shidren for di year wen dem dey free pipol. 25Di priest go fix all di prize, just as dem tok for di sanctuary.
Vow For First-born
26“ ‘Di first pikin for evry animal na God own, so make anybody nor dedikate am to God as ofrin from en mind. Weda na melu or kattle, na God get am. 27But animal wey nor klean, dem go fit buy en first pikin back for di normal prize kon add twenty percent join. If e nor buy am back, dem go sell am give anoda pesin for di normal prize.
Tins Wey Bi God Own
28“ ‘Make anybody nor sell or buy wetin dem don dedikate give God without kondishon. Weda na human being, animal or land, bikos na God own forever. 29Even if na human being, if dem dedikate am without any kondishon, dem nor go fit buy am back; dem must kill-am.
Vow For Tithe
30“ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own. 31If anybody one buy am back, e must pay di normal prize kon add twenty percent join. 32One out of evry ten animal wey dey stay house, go bi God own. Wen dem don kount di animals finish, di tent one go bi God own. 33Di owner nor go arrange di animals, so dat dem go fit choose di bad one and make e nor shange any one wey dem choose. If e shange any animal for anoda one, den di two animal go bi God own and e nor go fit buy dem back.’ ”
Konklusion
34Dis na di kommand wey God give Moses for Mount Sinai and na for Israel pipol.
Iliyochaguliwa sasa
Levitikus 27: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili
Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee