Jenesis 37
37
Josef Dream
1Jakob kon go stay for di land where en papa bin stay for Kanaan.
2Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem. 3Israel love Josef pass all en sons, bikos e don old before dem born am, so e kon make one special koat for am. 4Wen Josef brodas si sey dia papa like am pass dem, dem kon hate Josef and dey tok to am anyhow.
5Josef dream and wen e tell en brodas about wetin e dream, dem kon hate am more-more. 6E tell dem sey, “Make una listin to my dream: 7E get many korn for di field centre. At wons my korn stand up for di centre and una korn kon bow down for am!”
8Den en brodas ask am, “So yu really tink sey yu go rule ova us or get pawa pass us?” So dem kon hate am more-more, bikos of di dream and wetin e tok.
9Den, Josef dream anoda dream kon tell en brodas. “Make una si, I dream anoda dream. For dis dream, di sun, di moon and eleven stars kon bow down for mi.”
10Wen e tell en papa and en brodas, en papa shaut for am kon sey, “Wetin bi dis dream wey yu dey dream? So mi, yor mama and all yor brodas go really kom bow down for yu?” 11Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.
Dem Sell Josef
12Wen en brodas don go find food for dia papa animals near Shekem, 13Israel kon tell Josef, “Yor brodas dey for di field near Shekem. Make yu kom make I send yu go meet dem.”
Josef ansa, “Papa! I don ready.”
14So Jakob tell am, “Make yu go si as yor brodas and di animals dey, den kon tell mi weda dem dey okay.” So Jakob send am go from Hebron Valley.
15Wen Josef rish Shekem, one man kon si am dey waka anyhow for di field, so di man ask am, “Na wetin yu dey find?”
16Josef ansa, “I dey find my brodas. Abeg make yu tell mi where dem and di animals dey.”
17Di man kon sey, “Dem don komot dis aria, bikos I hear wen dem dey sey, ‘Make wi go Dotan.’ ” So Josef find en brodas go Dotan.
18Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am. 19Dem tell each oda, “Si di oga wey sabi dream dey kom! 20Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”
21Wen Reuben hear wetin dem tok, e kon save Josef from dia hand wen e sey, “Make wi nor kill-am!” 22Reuben still sey, “Make wi nor put blood for awa head! So make wi trow am for gutta for here inside dis wildaness, but make una nor tosh am at-all.” (Reuben tok like dis so dat leta, e go-go save Josef give en papa.)
23Wen Josef rish where en brodas dey, dem komot en fine koat for en body, di one wey e papa make for am. 24Den dem take am kon trow am put for one deep gutta. (Di gutta dey empty; wota nor dey inside.) 25Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
26Den Judah kon tell en brodas, “Wetin wi go gain if wi kill awa own broda kon kover en blood? 27So make wi sell am give dis Ishmael pipol, but make wi nor kill-am, bikos e still bi awa broda; awa flesh and blood.” En brodas kon agri with wetin e tok. 28So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.
29Leta, wen Reuben go back to di gutta, e kon si sey Josef nor dey der again! E tear en klot 30kon go meet en brodas sey, “Josef nor dey der again! So naw, where I won find am go?”
31So dem take Josef koat kon kill one small goat, den soak am inside di blood. 32Dem take di koat go give Jakob sey, “Dis na wetin wi si. Make yu look am well weda na yor pikin Josef own or not.”
33Jakob look am well kon sey, “Na my pikin own! One wiked animal don chop am! So, Josef don really die for wiked animal hand?” 34Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well. 35All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
36Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.
Iliyochaguliwa sasa
Jenesis 37: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee