1
Jenesis 37:5
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Josef dream and wen e tell en brodas about wetin e dream, dem kon hate am more-more.
Linganisha
Chunguza Jenesis 37:5
2
Jenesis 37:3
Israel love Josef pass all en sons, bikos e don old before dem born am, so e kon make one special koat for am.
Chunguza Jenesis 37:3
3
Jenesis 37:4
Wen Josef brodas si sey dia papa like am pass dem, dem kon hate Josef and dey tok to am anyhow.
Chunguza Jenesis 37:4
4
Jenesis 37:9
Den, Josef dream anoda dream kon tell en brodas. “Make una si, I dream anoda dream. For dis dream, di sun, di moon and eleven stars kon bow down for mi.”
Chunguza Jenesis 37:9
5
Jenesis 37:11
Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.
Chunguza Jenesis 37:11
6
Jenesis 37:6-7
E tell dem sey, “Make una listin to my dream: E get many korn for di field centre. At wons my korn stand up for di centre and una korn kon bow down for am!”
Chunguza Jenesis 37:6-7
7
Jenesis 37:20
Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”
Chunguza Jenesis 37:20
8
Jenesis 37:28
So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.
Chunguza Jenesis 37:28
9
Jenesis 37:19
Dem tell each oda, “Si di oga wey sabi dream dey kom!
Chunguza Jenesis 37:19
10
Jenesis 37:18
Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.
Chunguza Jenesis 37:18
11
Jenesis 37:22
Reuben still sey, “Make wi nor put blood for awa head! So make wi trow am for gutta for here inside dis wildaness, but make una nor tosh am at-all.” (Reuben tok like dis so dat leta, e go-go save Josef give en papa.)
Chunguza Jenesis 37:22
Nyumbani
Biblia
Mipango
Video