Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God. Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.