Nombas 7
7
Leaders Ofrin
1Wen Moses don set di Tabanako finish, e kon anoint and dedikate di tent, di altar and evritin wey dey inside. 2Den di leaders for Israel, di heads for di tribes kon give one ofrin. Na dis pipol bi leaders for di tribes and na dem dey monitor di kountin. 3Di ofrin wey dem bring to God na: six truck and twelf melu. One truck na for two leader and one melu for each leader, so dem give dem to God for di Tabanako front.
Di Gift
4Den God tell Moses: 5“Make yu kollect dis tins from dem kon give dem to Levi pipol make dem take do dia difren-difren work.” 6So Moses give di truck and di melu to Levi pipol. 7E give two truck and four melu to Gershon pipol, 8four truck and eight melu to Merari pipol and na Itama, Aaron pikin dey direct dem for dia work. 9But Moses nor give Kohat pipol any truck or any melu, bikos na di holy tins wey dem karry for dia shoulder, bi dia work.
Di Time
10Di leaders bring gift to take dedikate di altar wen dem don anoint am kon drop dem der. 11Bikos God tell Moses sey, “Dem must give dia ofrin to take dedikate di altar; one leader for each day.”
Di Tribes Ofrin
12Di one wey give en ofrin for di first day na Nahshon wey Amminadab born and na from Judah tribe e from kom.
13En ofrin na one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, but na akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 14one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 15one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 16one man goat for klean ofrin 17and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Nahshon, wey Amminadab born, give.
18For di sekond day, Netanel wey Zuar born, wey dey lead Issakar tribe kon give en ofrin.
19Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 20one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 21one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 22one man goat for klean ofrin; 23and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Netanel, wey Zuar born, give.
24For di third day, Eliab wey Helon born, wey bi leader for Zebulun tribe kon give en ofrin.
25Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 26one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 27one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 28one man goat for klean ofrin; 29and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliab, wey Helon born, give.
30For di fourt day, Elizur wey bi Shedeur pikin, di leader for Reuben tribe kon give en ofrin.
31Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 32one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 33one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 34one man goat for klean ofrin; 35and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elizur, wey Shedeur born, give.
36For di fift day Shelumiel wey Zurishaddai born, wey dey lead Simeon tribe kon give en ofrin.
37Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 38one gold pan wey heavy rish ten shekel; 39one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 40one man goat for klean ofrin; 41and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Shelumiel, wey Zurishaddai born, give.
42For di sixt day, Eliasaf wey Deuel born, wey dey lead Gad tribe kon give en ofrin.
43Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 44one gold pan wey heavy rish ten shekel; 45one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 46one man goat for klean ofrin; 47and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliasaf, wey Deuel born, give.
48For di sevent day, Elishama wey Ammihud born, wey dey lead Efraim pipol, kon give en ofrin.
49Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 50one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 51one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 52one man goat for klean ofrin; 53and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elishama, wey Ammihud born, give. 54For di eight day, Gamaliel wey Pedahzur born, wey dey lead Manasseh tribe, kon give en ofrin. 55Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 56one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 57one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 58one man goat for klean ofrin; 59and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Gamaliel, wey Pedahzur born, give.
60For di ninet day, Abidan wey Gideoni born, wey dey lead Benjamin tribe, kon give en ofrin.
61Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 62one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 63one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 64one man goat for klean ofrin; 65and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Abidan wey Gideoni born give.
66For di tent day, Ahiezer wey Ammishaddai born, wey bi leader for Dan tribe, kon give en ofrin.
67Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 68one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 69one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 70one man goat for klean ofrin; 71and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahiezer, wey Ammishaddai born, give.
72For di elevent day, Pagiel wey Okran born, wey dey lead Asher pipol, kon give en ofrin.
73Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 74one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am; 75one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 76one man goat for klean ofrin; 77and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Pagiel, wey Okran born, give.
78For di twelft day, Ahira wey Enan born, wey bi leader for Naftali pipol, kon give en ofrin.
79Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin; 80one gold pan wey heavy rish ten shekel; 81one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin; 82one man goat for klean ofrin; 83and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahira, wey Enan born, give.
Konklusion
84Dis na di whole ofrin wey di leaders for Israel give for di altar, wen dem don anoint am: twelf silva plate, twelf shine-shine silva bowl and twelf gold pan. 85Each silva plate heavy rish one hundred and three shekel and each shine-shine silva bowl heavy rish seventy shekel. All di silva vessel dem heavy rish 2,400 shekel, akordin to di sanctuary shekel. 86Di twelf gold pans wey incense full heavy rish ten shekel and na akordin to di sanctuary shekel; all di pan wey bi gold heavy rish one hundred and twenty shekel. 87All di animal wey dem use for di burnt ofrin na twelf small melu, twelf ram, twelf man lamb wey bi one year, with dia korn ofrin and twelf man goat for klean ofrin. 88All di animals wey dem sakrifice for peace ofrin na twenty-four small melu, sixty ram, sixty man goat and sixty lamb wey bi one year. Dis na di whole ofrin wey dem give to take dedikate di altar afta dem don anoint am.
89Naw, wen Moses don enter di tent, God kon tok to am for di Kovenant Box top; between di two image wey bi like angel wey dem dey koll cherubim.
Iliyochaguliwa sasa
Nombas 7: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili
Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee