Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Nombas 4

4
Kohat Pipol Work
1God tell Moses and Aaron: 2“Kohat pipol wey kom from Levi tribe, make dem kount dem akordin to dia family and towns. 3Make dem kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
4“Dis na di work wey Kohat pipol go do for di tent where dem for dey do meetin and koncerning di holy tins. 5Wen time don rish for di pipol to travel, Aaron and en sons must enter di tent kon take di curtain take kover di Kovenant Box. 6Den dem go use fine leda take kover am kon spread blue klot on-top. Den, dem must put di poles wey dem go take karry am for inside.
7“Make dem use blue klot kover di tabol wey God bread dey, di plate, di incense bowl, di ofrin bowl and di jar wey dem dey use for wine ofrin. Bread must always dey di tabol. 8Dem must use red klot and fine leda take kover am, den put di poles wey dem go take karry am for inside.
9“Di lampstand, di lamps, di fork, tray and all di olive oil kontaina wey dey der, dem go kover am with blue klot. 10Make dem wrap am with di oda tools with fine leda kon put am for sometin wey dem go fit take karry am.
11“Dem go spread blue klot for di altar wey dem make with gold kon kover am with fine leda and di poles wey dem go take karry am, go dey inside. 12Dem go take all di tools wey dem dey use for di Holy Place, wrap dem with blue klot; use fine leda take kover dem kon put dem for sometin wey dem go fit take karry dem.
13“Dem go still remove di ashes wey dey di altar kon kover am with purpol klot. 14Den all di tools wey dem dey use take work for di altar, dem go put am on-top: di tray, di hook, shovel and basin. Den dem go kover am with fine leda kon put di poles wey dem go take karry am for inside. 15Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
16“Di work wey dem give Aaron son, Eleazar, na di whole tent and di oil wey dey di lamps, di incense, di korn ofrin, di anointin oil and evry oda tin wey dey di tent wey dem don make holy for God.”
17God tell Moses and Aaron, 18“Make una nor allow God remove Kohat family from Levi tribe; 19but dis na wetin una go do for dem, so dat dem nor go die wen dem go near di holy tins: Aaron and en sons go give each man en own work. 20Kohat pipol nor go-go inside go look wen dem dey kover di holy tins, if not, dem go die.”
Gershon Pipol Work
21God kon tell Moses: 22“Gershon pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns. 23Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 24Gershon pipol work na to karry dis tins wey bi: 25di tent, di kover for inside and outside, di fine leda kover on-top am, di curtain for di door-mot, 26di curtains and di ropes for di kourt wey round di tent and di altar; di curtains wey dey di kourt door-mot and all di tins wey dem use take arrange dem. So na dem go do dis work. 27Moses and Aaron go make sure sey Gershon pipol do all di work and karry evritin wey Aaron and en sons suppose use. 28Dis na di work wey Gershon pipol go do for di tent; dem go karry am komot, just as Aaron pikin, Itama, kommand dem.”
Merari Pipol Work
29God tell Moses, “Merari pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns. 30Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 31Dia work go bi to karry di frame, bar, post and base for di tent. 32Di oda post, base, peg and ropes for di kourt wey round di tent, with all di tins wey dem take make dem. Each man go karry di tins wey dem sey make e karry. 33Dis na di work wey Merari pipol go do for di tent: dem go karry dem komot, just as Aaron tell dem.”
Konklusion
34So Moses, Aaron and di leaders kon kount Kohat pipol akordin to dia family and towns, 35from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 36Doz wey dem kount akordin to dia family na 2,750. 37Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Kohat family, evribody go work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
38Doz wey dem kount for Gershon family, akordin to dia family and towns, 39from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 40Doz wey dem kount akordin to dia family and towns na 2,630. 41Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Gershon family wey fit work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
42Doz wey dem kount for Merari family, akordin to dia family and towns, 43from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin 44na 3,200. 45Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Merari family, just as God kommand.
46All di pipol for Levi tribe, wey Moses, Aaron and di leaders kount akordin to dia family and towns, 47from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin, 48na 8,580.
49Moses kount all dis pipol, just as God kommand am and each pesin get en work.

Iliyochaguliwa sasa

Nombas 4: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia