Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Levitikus 5

5
Oda Laws For Sin Ofrin
1“ ‘If dem koll yu make yu kon tok about sometin wey yu si or wey happen for yor present and yu nor gri, yu don sin bi dat and dem must ponish yu.
2“ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.
3“ ‘Or if yu by mistake tosh sometin wey dey make pesin dirty for God eye, den wen yu know, yu must gri sey yu don sin. 4May bi pesin make vow wey e nor sirious about, no matter wetin e bi, e don kommit sin wons e know wetin e do.
5“ ‘If anybody know sey e dey guilty for wetin e do, dat pesin fit go konfess en sin. 6Den e must bring woman goat or sheep kon give God as ofrin for en sin. Dis na sin ofrin wey di priest go take klean am, so dat God go forgi-am.
7“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin. 8E go bring dem kom meet di priest, wey go first offa di bird for di sin ofrin kon break en neck, but e nor go komot di neck from di body. 9Den e go sprinkol some of di sin ofrin blood for di altar kon pour di remainin one under di altar. Dis na for di sin ofrin. 10Den e go offa di sekond bird as burnt ofrin akordin to di law. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
11“ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin. 12E go bring am kom meet di priest wey go pak di flower full en hand as di sin ofrin to God, den e go burn am for di altar as food ofrin, even doh na sin ofrin e bi. 13As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. Di remainin flower na di priest own, just as e bi for korn ofrin.’ ”
Guilt Ofrin
14Den God tell Moses: 15“Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel. 16Any holy tin wey e spoil, e must pay back and e go add twenty percent give di priest and di priest go offa di animal as sakrifice for di sin wey di man kommit, den God go forgi-am.
Sin Wey Pesin Nor No
17“If anybody break God kommand and e nor know, di pesin dey guilty and e must pay for en sin. 18E go bring man sheep or goat wey dey okay kon give di priest as ofrin for en sin. Den e go measure am akordin to di Tabanako shekel. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. 19Dis ofrin na for di sin wey pesin sin against God.”

Iliyochaguliwa sasa

Levitikus 5: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia