Levitikus 3
3
Peace Ofrin
1“ ‘Wen pesin won give en animal as peace ofrin, e fit bi man or woman own, but di animal must dey okay. 2Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side 3kon give all dis parts for di animal to God as food ofrin: all di fat wey dey inside di animal intestine; 4di kidney, di fat wey dey di kidney and di part for di liver wey good well-well. 5Di priest go burn all of dem for di altar with di burnt ofrin. God like dis food ofrin smell well-well.
Animal For Peace Ofrin
6“ ‘Dem fit use sheep or goat take do peace ofrin, weda na man or woman, but e must dey okay. 7If una give sheep as ofrin, una must gi-am for God present. 8Una go put una hand for di animal head kon kill-am for where dem for dey do meetin for di tent door-mot. Di priest go rub di blood for di altar four side 9kon give all dis part to God as food ofrin: di fat, all di fat tail wey dem kut komot from near di backbone; all di fat wey kover di animal intestine; 10di kidney and di fat wey dey di kidney; plus di part for di liver wey good well-well. 11Di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God.
12“ ‘If una give goat as una ofrin, una must bring am kom God present, 13put una hand for di animal head kon kill-am for di tent front. Di priest go rub di blood for di altar four side 14kon give all dis part to God as food ofrin: all di fat wey dey di intestine, 15di two kidney with dia fat and di part for di liver wey good well-well. 16Den di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God and God like am well-well. All di fat na God own.
17“ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”
Iliyochaguliwa sasa
Levitikus 3: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili
Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: