Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Levitikus 19

19
Laws For Evriday Life
1God tell Moses: 2“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy. 3Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God. 4Make una nor woship juju or make juju with iron. Na mi bi di Oga una God.
Peace Ofrin Food
5“ ‘Wen una won give una peace ofrin to God, una must sakrifice am well, so dat I go asept am. 6Una must chop am for di day wey una sakrifice am or di next day, but una go burn di ones wey remain with fire for di third day, 7bikos e don dey unklean. If anybody chop am, I nor go asept di ofrin. 8Anybody wey chop am go dey guilty, bikos e trit wetin dey holy wey dem give to God like ordinary tin and e nor go dey among my pipol again.
Harvest Law
9“ ‘Wen una don gada di tins wey una harvest for una land, make una nor kut di korn wey dey di land front and make una nor go back go kut di korn wey remain. 10Make una nor go una farm back go gada grape wey don dey yuzles or pick di grape wey fall for groun; but make una leave dem for poor pipol and strenjas. Na mi bi Oga una God.
Dey Do Well
11“ ‘Make una nor play wayo, tif or lie. 12Make una nor lie with my name kon promise pipol, bikos una go disgrace my name. Na mi bi di Oga una God. 13Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem. 14Make una nor curse anybody wey nor dey hear or set trap for blind pesin. Una must fear una God; bikos na mi bi God.
To Judge Well, Love And Kindness
15“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money. 16Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God. 17Make una nor keep malice with anybody, but make una setol una kworel with dat pesin, so dat una nor go sin, bikos of dat pesin. 18Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God. 19Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.
To Sleep With Slave
20“ ‘If man sleep with woman slave wey anoda man suppose marry and dem neva free or pay money for en head, den dem must pay evritin komplete. Dem nor go kill-am, bikos di woman na slave. 21Di man go bring ram kom di tent gate for God present as guilt ofrin 22and di priest go make sakrifice for am for di sin wey e kommit.
Three Fruit
23“ ‘Wen una enter di land kon plant tree for food, make una nor chop di first fruit wey e go bear. Make una nor chop am for di first three years. 24For di fourt year, all en fruit go dey holy and e go bi praiz ofrin to God. 25Den for di fift year, una fit chop di fruit wey e bear kon add am join una harvest. Na mi bi di Oga una God.
Blood, Hair And Body
26“ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju. 27Una must nor kut di hair wey kover una head or barb una bear-bear, 28or draw picture for body; or kut mark to mourn pesin wey die. Na mi bi God. 29Make una nor disgrace una girl pikin kon make am bi like ashawo; if una do like dat, di land go turn where ashawo and wiked pipol full.
Honor, Klean, Respet And True
30“ ‘Make una keep di Sabat Day and honor di house where una for dey woship mi. Na mi bi God. 31Make una nor go take advise from pipol wey dey serve dead pipol spirit. If una do am, una go dey unklean. Na mi bi Oga una God. 32Make una dey respet and honor pipol wey senior una. Make una fear una God; Na mi bi God. 33Make una nor ponish strenjas wey dey stay for una land. 34Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God. 35Make una nor play wayo wen una dey measure how sometin long and wide rish or oda tins wey many. 36Make una dey measure well for evritin wey una dey do. Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt. 37Make una obey all my laws and kommandment. Na mi bi God.’ ”

Iliyochaguliwa sasa

Levitikus 19: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia