Exodus 8
8
1Den God tell Moses, “Go tell Fero sey, ‘Dis na wetin God tok, “Make yu let my pipol go serve mi! 2But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa. 3Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota. 4Di frog go trobol yu, yor pipol and all yor savants for dis land.” ’ ”
5God tell Moses, “Go tell Aaron, ‘Take di stik wey dey yor hand take face di river, creek and di ponds and frog go full evriwhere for Egypt.’ ” 6So as Aaron stresh di stik on-top di wota wey dey Egypt, frog kom full evriwhere for di land. 7Di juju-men sef kon use dia juju pawa take bring frog join di ones wey dey di land.
8Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
9So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”
10Fero ansa, “Na tumoro.”
Den Moses sey, “E go bi as yu tok, so dat yu go know sey nobody bi like di Oga wey bi awa God. 11Di frog go komot from yu, all yor savants and yor pipol house and na only di frog dem for inside River Nile, go remain.”
12Moses and Aaron kon waka leave Fero. Den Moses pray to God make E remove di frog wey E send kon meet Fero. 13God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die. 14Egypt pipol gada di frog and dem nor fit kount am, den evriwhere kon dey smell for di land. 15But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.
Third Wahala: Plenty San-san Fly
16God kon tell Moses, “Make yu tell Aaron sey, ‘Nak di san with di stik wey dey yor hand and plenty san-san fly go kom out for evriwhere for Egypt.’ ” 17So Aaron nak di san with en stik and san-san fly kon full evriwhere for Egypt. 18Wen di juju-men try to bring out san-san fly with dia juju pawa, dem nor fit do am. So san-san fly kon dey gada both Egypt pipol and dia animals.
19Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.
Fourt Wahala: Plenty Fly
20God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi! 21If yu nor gri let dem go, I go send plenty fly kom meet yu, yor savants, yor pipol and for inside una house. All Egypt pipol house and di groun go full with fly. 22And for dat day, I nor go let di fly dem rish Goshen land where my pipol dey, so dat yu go know sey na mi, di Oga God dey do dis tins. 23I go divide my pipol from yor pipol. Dis sign go happen tumoro.” ’ ”
24God do as E tok and fly wey dem nor fit kount kon full Fero, en savants and Egypt pipol house and many tins spoil, bikos of di fly dem.
25Den Fero koll Moses and Aaron kon sey, “Make una go sakrifice to una God inside di land.”
26But Moses sey, “Dat nor bi wetin wi suppose do, di kind sakrifice wey wi won do for di Oga awa God na wetin Egypt pipol dey forbid. If wi make sakrifice wey Egypt pipol dey forbid for dia face, dem nor go stone us die? 27So wi must travel for three days go inside di wildaness go sakrifice to di Oga awa God, just as E don dey tell us since.”
28Fero kon sey, “I go let una go sakrifice give di Oga una God inside di wildaness, but una nor go-go too far. Make una pray for mi too.”
29Moses ansa, “I go leave yu go pray to God and tumoro, all di fly go komot from Fero, en savants and en pipol, so-far yu nor go deceive us again or nor let us go sakrifice to awa God.”
30So Moses komot from where Fero dey kon go pray 31and Oga God do as Moses ask. E remove all di fly from Fero, en savants and en pipol. 32But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 8: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee