Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Exodus 6

6
God Koll Moses
1Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.” 2So God tell Moses, “Na mi bi Oga God. 3‘Na mi appear to Abraham, Isaak and Jakob as di Almighty God, but di pipol nor know sey my name na Oga God,’ too. 4I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’ 5Naw, I don hear Israel pipol kry, bikos of how Egypt pipol dey sofa dem and I don remember my kovenant.
6“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol. 7I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una. 8I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ”
9Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa.
10Den God tell Moses, 11“Make yu go tell Fero wey bi Egypt king sey e must free Israel pipol from en land.”
12But Moses ansa, “If Israel pipol nor gri listin to mi, den how Fero go kon take listin to mi, since I nor dey fit tok well?”
13God kon kommand Moses and Aaron about Israel pipol and E sey make dem tell Fero wey bi king for Egypt sey make e free Israel pipol from en land.
Moses And Aaron Family
14Dis na di head for di difren family for Israel:
Reuben wey bi Israel first pikin, born Hanok, Pallu, Hezron and Karmi. Na dis pipol bi Reuben family.
15Simeon shidren na Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul wey en mama kom from Kanaan. Na dis pipol bi Simeon family.
16Levi shidren akordin to dia rekord na Gershon, Kohat and Merari. (Levi stay for one hundred and thirty-seven years.)
17Gershon shidren akordin to dia family, na Libni and Shimei.
18Kohat shidren na Amram, Izhar, Hebron and Uzziel. (Kohat stay for one hundred and thirty-three years.)
19Merari shidren na Mahli and Mushi.
Na dis pipol kon bi Levi family akordin to dia rekord.
20Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die).
21Di shidren wey Izhar born na Korah, Nefeg and Zikri.
22Uzziel shidren na Mishael, Elzafan and Sitri.
23Aaron marry Elisheba wey bi Amminadab dota and Nahshon sista. Di woman born Nadab, Abihu, Eleazar and Itama for Aaron.
24Korah pikin na Assir, Elkanah and Abiasaf. Na dis pipol bi Korah family.
25Naw, Eleazar wey bi Aaron pikin marry one among Putiel dota and e born Finehas for Eleazar.
Na all dis pipol kon bi Levi tribe.
26Na dis Aaron and Moses, God still tell sey, “Make una take Israel pipol komot from Egypt.” 27Na dem bi di men wey tok to Fero, so dat dem go fit take Israel pipol komot from Egypt.
God Kommand Moses And Aaron
28Wen God tok to Moses for Egypt, 29E tell am, “Na mi bi di Oga, yor God. All di tins wey I dey tell yu since, make yu go tell Fero wey dey rule Egypt.” 30But Moses ansa, “Since I nor fit tok well, how Fero go take listin to mi?”

Iliyochaguliwa sasa

Exodus 6: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia