Exodus 5
5
Moses and Aaron Go Meet Fero
1Den Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “Israel God sey, ‘Make yu allow my pipol travel go di wildaness go woship and honor mi.’ ”
2But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”
3Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”
4Den di king tell dem, “Moses and Aaron, na una dey make di pipol nor gri do dia work, abi? Make una go back go kontinue una work. 5Una pipol don too many for dis land pass Egypt pipol. And naw, una wont stop work.”
6For dat di same day, Fero kon kommand di slave oga dem sey, 7“Make una stop to give di pipol wetin dem take dey make block. But make only dem go find kon make block. 8And una go force dem make plenty block, just as dem dey do before. Na bikos dem nor get enough work naim make dem dey kom ask mi sey, ‘Make yu let us go sakrifice give awa God.’ 9Make una give dem strong work, so dat dem nor go get shance to listin to lie-lie word!”
10So all di slave oga kon go tell Israel pipol, “Fero sey: ‘I nor go give una wetin dem take dey make block again. 11But na only una go-go find dem and di block wey una go make must bi di same as before.’ ” 12So di pipol kon bigin waka for inside Egypt dey find wetin dem take dey make block.
13Di slave oga still dey force and tell dem, “Una must finish evriday work, just as e bi wen wi dey give una dry stik take work!” 14Fero pipol kon bigin beat Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol, den dem ask dem, “Why una nor komplete una work yestiday and today, just as una dey do before?”
15Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol kry go meet Fero kon sey, “Why yu dey sofa yor savants like dis? 16Dem nor gri give us, yor savants dry stik, instead dem dey beat and tell us sey make wi make plenty block, even doh na dem dey wrong.”
17Den Fero ansa, “Una lazy and nor won work, if not una nor go sey, ‘Make yu allow us go sakrifice give awa God.’ 18So make una go back go work. Dem nor go give una dry stik again and una must still make di block rish as una dey do am before!”
19Israel pipol wey dem take make oga ova dia own pipol kon know sey dem don enter trobol as di king sey, “Una must make di block rish as una bin dey do am.” 20Afta dem leave Fero, dem kon go meet Moses and Aaron wey bin dey wait for dem kon 21sey, “Make God judge una, bikos una don make di king and en workers hate us and una don give dem shance to kill us!”
Moses Cry Give God
22Moses go back go meet God kon sey, “God! Why Yu kon kause trobol for dis pipol? Wetin make Yu send mi kom? 23Since I go tok to Fero with yor name, di kind sofa wey e dey sofa yor pipol kon worse pass as e bi before and Yu neva still kom save dem!”
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 5: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee