Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Exodus 38

38
Burnt Ofrin Altar
1E use akasia wood take make di burnt ofrin altar. E long rish seven and half fit; wide rish seven and half fit skware and e high rish four and half fit. 2E make horn for en four kornas; di horns na part of am. And e kover dem with bronze. 3Den e make all wetin dem go use for di altar. Tins like pot, shovel, tossin pot, meat hook and fire pan and na bronze e take make all of dem. 4E make bronze frame for di altar and for under am. 5E make four rings for di bronze frame for di four korna, so dat space go dey for di poles. 6E take akasia wood make poles kon kover dem with bronze. 7Den e put di poles inside di rings for di altar. E make di altar with board and e get holes.
Di Bronze Basin
8E make di bronze basin and en bronze stand from di mirror wey bilong to di wimen wey dey serve for di Tabanako gate.
Di Kourtyard
9E make di kourtyard for di sout-side kon hang en curtain with fine linen wey long rish one hundred and fifty fit, 10with dia twenty post, dia twenty bronze stand, silva hooks and rods. 11For di nort side, di curtain na one hundred and fifty fit, with dia twenty post, dia twenty bronze stand, silva hooks and rods. 12For di west side, di curtain long rish seventy-five fit, with dia ten posts; di ten stand; dia silva hooks and rods. 13Den for di east side where di sun from dey raiz, di curtain wide rish seventy-five fit too. 14Di curtains for one side long rish twenty-two and half fit, with dia three post and three stand. 15For di sekond side for di kourtyard gate, just like di oda one, di curtain long rish twenty-two and half fit, with di three post and three stand to support am. 16Na fine linen dem take make all di curtains wey round di kourtyard. 17Di stands for di posts na bronze. Di hooks for all di post and dia band, na silva and dem kover dem with silva for dia top. All di kourtyard posts get silva bands. 18Di curtain for di kourtyard gate na blue, purpol and red wool with fine linen and dem design dem well-well. E long rish three fit and like di curtain for di kourtyard, na so too e high rish seven and half fit 19with four post and four bronze stands. Dia hook and rods na silva and dem kover dem with silva for top. 20All di tent pins for di Tabanako and round di kourtyard, na bronze dem take make dem.
Di Tins Wey Dem Use
21Dis na di materials wey dem use take build di Tabanako, just as Moses tok. Na Levi pipol do di work and Itama wey bi Aaron pikin, na-im dey show dem wetin dem go do. 22Naw, Uri pikin Bezalel wey Hur wey kom from Judah bi en grand-papa, make evritin just as God kommand Moses; 23and Oholiab wey bi Ahisamak pikin wey kom from Dan tribe, dey with am and e dey karve; design and weave blue, purpol and red wool with fine linen. 24All di gold wey dem use for di Tabanako work, na ofrin wey rish twenty-nine talent and seven hundred and three shekel akordin to di Tabanako shekel. 25And di silva from di pipol wey dem kount for di kommunity na one hundred talent and 1,775 shekel as dem go kount am for di Tabanako. 26Dis amount na di same for each pesin. Na di same as half shekel akordin to di Tabanako shekel, bikos di pipol wey plenty rish like dat from twenty years go up, na 603,550 dem bi. 27Na one hundred talent of silva dem use take make di stand for di Tabanako and di curtain; one hundred stand na for one hundred talent; while one talent na for each stand. 28From di 1,775 shekel wey remain, Bezalel make hooks for di posts kon kover dia top, den e make rod for dem. 29Di bronze from di ofrin na seventy talent and 2,400 shekel. 30With dem, Bezalel make di stand for di tent door where dem for dey do meetin and di bronze altar; di bronze frame for am and all di tins wey dem go use for di altar, 31round di stands for di kourtyard and di stands for di gate; all di tent pins with di ones wey dey round di kourtyard.

Iliyochaguliwa sasa

Exodus 38: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia