Exodus 34
34
Di Two Stone
1God kon tell Moses, “Make yu kut two stones kom out like di first ones wey yu skata, den I go rite di same word put for dis ones. 2Ready for morning den make yu klimb go Mount Sinai go wait for mi. 3Make nobody follow yu klimb or near di mountin. Make any animal nor kom chop grass under di mountin.” 4So for early morning, Moses kut two stones like di first ones kon klimb go Mount Sinai, just as Oga God kommand am and e karry di two stones follow body.
5God kom down inside di kloud kon stand der with Moses, den E koll en own holy name wey bi Oga God. 6God pass en front kon sey, “Na mi bi Oga God. I bi God wey get mesi and pity; I nor dey kwik vex; just as I big na so too my love big rish and I nor dey fail. 7I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”
8So Moses kwik-kwik bow woship am 9kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”
Renew Kovenant
10God sey, “Si, I go make kovenant with Israel pipol. For dia present, I go do many wonders wey neva happen for anywhere for dis world or any kountry. And all di pipol wey dey with yu go si God work, bikos na wetin dey fear pesin, I dey do with una. 11Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.
12“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol wey dey di land wey una dey go, if not, e go bi trap for una. 13But una must distroy dia altars; skata dia images and kut dia Asherah juju poles trowey. 14Una must nor woship any oda god, bikos di Oga God wey en name na Jealousy, na God wey dey really jealous.
15“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol for di land, bikos wen dem bigin woship and sakrifice to dia juju, dem go koll una make una join dem, den una go chop from dia sakrifice; 16marry dia dotas for una sons and dia dotas go make una nor serve mi well, instead una go kon dey woship dia juju. 17Make una nor mold or woship any gods.
18“Una must always dey do di bread wey nor get yist feast. Una must chop bread wey nor get yist for seven days, just as I kommand and e go bi for Abib mont, bikos na for dat mont, una take komot from Egypt.
19“Evry first-born wey bi man na my own; even di first pikin wey kattle, melu or sheep born. 20Una fit use one lamb take buy donkey first pikin back, but if una nor go fit shange am, den make una break en neck. Una must buy all una first-born back. Nobody go kom meet mi with empty hand.
21“Una go work for six days, but for di sevent day, una must rest; even if na wen una dey prepare una land to plant or harvest. 22Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end. 23Three times evry year, all una men must kom stand before di Oga wey bi Israel pipol God. 24Bikos una dey kom meet mi di Oga una God three times evry year, I go drive di pipol for doz kountry wey won stop una and I go make una land big; so dat nobody go fit take una land.
25“Make una nor offa my sakrifice blood with yist and di sakrifice from di Passova Feast, must nor remain rish di next day. 26Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm kom di Oga una God house. Make una nor kill or chop animal wey still dey suck breast.”
27God tell Moses, “Make yu rite dis words, bikos I don use dis word make kovenant with yu and Israel pipol.”
28So Moses dey der with Oga God for forty days and forty nites; Moses nor chop bread or drink wota. E rite di kovenant word for di two stones and na dem bi di ten kommandment.
Moses Face Shine
29Wen Moses kom down from Mount Sinai with di two stones wey dem rite di kommand put, Moses nor know sey en face dey shine as e dey tok with God. 30Wen Aaron and Israel pipol look Moses face, dem si sey e dey shine and dem kon dey fear to near am.
31But Moses koll dem kom meet am, so Aaron and all di leaders waka go meet am. Den Moses tok to dem. 32Afta dis, Israel pipol kon near am and e give dem all di kommandment wey God tell am for Mount Sinai. 33Wen Moses don tok to dem finish, e kon go kover en face with klot. 34But wen Moses dey go meet God, e dey remove di klot until e won kom meet di pipol. Den e go kom out kon tell Israel pipol wetin God kommand am. 35Wen ever Israel pipol si Moses face dey shine, Moses go kover en face until e won go meet and tok to God.
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 34: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: