Exodus 20
20
Di Ten Kommandment
1God kon sey:
2“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.
3Make una nor serve any oda God apart from mi.
4Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota. 5Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi. 6But I go show my love to many generashon, bikos dem love and keep my kommand.
7Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.
8Make una remember to keep di Sabat Day holy. 9Una get six days to do all una work, 10but for di sevent day wey bi di Oga una God Sabat Day, make nobody do any work; both una, una shidren, una savants, una animals or di strenjas for una kountry. 11Bikos na six days God take make heaven, eart and all di tins wey dey inside dem and E rest for di sevent day. So God bless di Sabat Day kon make am holy.
12Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
13Make una nor kill.
14Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
15Make una nor tif. 16Make una nor lie for una neighbour head.
17Make una nor get long-trot for una neighbour propaty; en wife, savants, melu, donkey or anytin wey bi en own.”
Di Pipol Fear
18Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place. 19Dem kon tell Moses, “Make yu tok to us and wi go listin, but make yu nor let God tok to us, so dat wi nor go die.”
20Moses tell di pipol, “Make una nor fear, God just kom test una, so dat una go fear and always dey obey en kommand.”
21Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
Di Altar
22God tell Moses, “Make yu go tell Israel pipol: ‘Una don si by unasef sey, I dey tok to una from heaven. 23So make una nor use silva or gold take make any oda god join mi.
24“ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der. 25And if una take stone build altar for mi, una must nor use stone wey dem kut, bikos if una kut di stones, una don spoil di altar bi dat. 26Make una nor build altar wey get step, so dat nobody go si una nakednes wen una dey klimb kon offa sakrifice give mi.’ ”
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 20: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee