Exodus 16
16
Manna From Heaven
1Wen Israel pipol komot from Elim, dem kon go Sin Wildaness wey dey between Elim and Sinai for di Fifteent day for di sekond mont afta dem don komot from Egypt. 2So evribody for Israel kon dey komplain give Moses and Aaron inside di wildaness.
3Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”
4Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment. 5But for di sixt day, make dem gada doubol of wetin dem bin dey gada.”
6So Moses and Aaron tell Israel pipol, “Dis evening, una go know sey na God take una komot from Egypt. 7For morning, una go si God glory, bikos E don hear as una dey komplain against am. Na-im una dey komplain to, nor bi wi wey just bi ordinary human being.” 8So Moses sey, “Wen God give una meat chop for evening and bread for morning, den una go know sey, E don hear all una komplain. Wetin wi bi sef? Una komplain nor bi against us, but na against God.”
9Den Moses tell Aaron sey make e tell Israel pipol make dem kom meet God, bikos E don hear all dia komplain. 10As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.
11Den God tell Moses: 12“I don hear Israel pipol komplain, so go tell dem, ‘Una go chop meat for evening kon chop bread for morning until una beleful, den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God.’ ”
13For evening, kwail bird kon fall full groun for di kamp and for morning dew gada evriwhere for di kamp. 14Wen di dew don komot, small-small round tins wey white like ice-blok still dey groun for di wildaness. 15Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi.
Den Moses tell dem, “Na di bread wey God send kom give una. 16Dis na wetin God kommand: ‘Make evribody take wetin e fit chop. One omer for one pesin; den una go gada akordin to di pipol wey dey una house.’ ”
17So Israel pipol do as God kommand. Some gada plenty, while odas gada small. 18Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.
19So Moses tell dem, “Make nobody keep dem till tumoro.” 20But some nor gri listin to Moses, bikos dem still keep some till di next day. Di food wey dem keep kon get worm and e start to smell, so Moses kon dey vex for doz pipol.
21So Israel pipol kon dey gada am evry morning; each pesin akordin to wetin e fit chop finish and wen sun don make evriwhere hot, di rest food go melt. 22For di sixt day, dem gada doubol food, two omer for one pesin. Den di leaders for di kommunity kom ask Moses, “Why e bi like dat.” 23Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
24So dem keep am till di next day, just as Moses kommand and e nor spoil, smell or get worm. 25Moses kon tell dem, “Make una chop am today, bikos today na awa God Sabat Day and una nor go si food chop for di field. 26Una go si gada for six days, but for di sevent day wey bi di Sabat Day, una nor go si any one gada or pick.
27“For di sevent day, some pipol among una go won go gada, but dem nor go si anytin gada.” 28So God tell Moses, “How long e go take before dis pipol go start to obey my kommandment? 29Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.” 30So di pipol rest for di sevent day.
31Israel pipol koll di food “Manna.” Bikos e bi like korianda seed and e white and dey taste like biscuit wey dem do with honey.
32Den Moses sey, “Dis na wetin God kommand: ‘Make una keep one full omer wey go dey from one generashon go rish anoda, so dat dem go si di food wey I dey give una for di wildaness, afta I take una komot from Egypt.’ ”
33Moses kon tell Aaron, “Make yu measure one omer for manna with one kontaina, den put am for where Oga God Spirit dey, so dat E go take am dey remember di generashon wey dey kom for back.” 34Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save. 35So Israel pipol chop manna for forty years until dem rish Kanaan land.
36(If yu divide efah into ten, na one part bi one omer.)
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 16: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee