Exodus 11
11
Last Wahala: Deat
1God kon tell Moses, “I go bring di last wahala to take ponish Fero and Egypt pipol and afta dis one, e go free una. E go drive una komot with evritin wey una get. 2So make yu go tell Israel pipol make dem ask dia neighbour for silva and gold.”
3(Naw, God don make Egypt pipol love Israel pipol. Even sef Moses kon bi one very big pesin for Egypt and Fero savants and Egypt pipol dey respet am.)
4Moses sey, “Oga God sey for mid-nite, I go waka pass evriwhere inside Egypt 5and all di first-born son for Egypt, go die. I go start from Fero first-born wey go take-ova en papa throne, go rish di first-born wey en slave girls wey dey grind korn born and all di first-born among en animals. 6Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again. 7But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol. 8All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.
9God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.” 10So Moses and Aaron do all dis wonders wey Fero si, but God make Fero heart strong, so dat e nor go let Israel pipol komot from Egypt.
Iliyochaguliwa sasa
Exodus 11: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee