Chapa ya Youversion
Ikoni ya Utafutaji

Exodus 1

1
God Bless Israel Pipol For Egypt
1Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body: 2Reuben, Simeon, Levi, Judah, 3Issakar, Zebulun, Benjamin, 4Dan, Naftali Gad and Asher. 5Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
6Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die. 7So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land. 8Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt. 9So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us! 10Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
11So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put. 12But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well, 13so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow. 14Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.
15Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey; 16“Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.” 17But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
18Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?”
19Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!”
20So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong. 21Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
22So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”

Iliyochaguliwa sasa

Exodus 1: pcm

Kuonyesha

Shirikisha

Nakili

None

Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia