How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”
God tell Moses, “I go still do wetin yu tok, bikos yu dey good for my eye and I know yu by yor name.”