“Make yu go kommand Israel pipol make dem give yu pure oil wey dem press komot from olive plant kon pour am for di lamp, so dat di lamps go always dey give lite. Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”