1
Mark 10:45
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos even Man Pikin nor kom make dem serve am, but e kom to serve pipol and to give en life make many pipol for dey save.”
Bandingkan
Telusuri Mark 10:45
2
Mark 10:27
Jesus look dem kon ansa, “Dis tins hard well-well for human being, but nor bi for God, bikos evritin dey possibol for God.”
Telusuri Mark 10:27
3
Mark 10:52
So, Jesus tell am, “Go, yor faith don heal yu.” At wons, di man kon dey si and e kon follow Jesus.
Telusuri Mark 10:52
4
Mark 10:9
So, wetin God don join togeda, make nobody separate am.”
Telusuri Mark 10:9
5
Mark 10:21
As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
Telusuri Mark 10:21
6
Mark 10:51
Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?” Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”
Telusuri Mark 10:51
7
Mark 10:43
But nor bi so e suppose bi among una. Anybody wey won bi oga among una, must bi una savant
Telusuri Mark 10:43
8
Mark 10:15
I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small shidren, nor go ever enter inside.”
Telusuri Mark 10:15
9
Mark 10:31
But many pipol wey bi first naw, go bi last and pipol wey bi last naw, go bi first.”
Telusuri Mark 10:31
10
Mark 10:6-8
But from di time God kreate di world, na man and woman naim E make. Na dis make man dey leave en papa and mama go join en wife and di two of dem go bi one. So dem nor go bi two again, but dem go bi one body.
Telusuri Mark 10:6-8
Beranda
Alkitab
Rencana
Video