Logo de YouVersion
Icono de búsqueda

Nombas 30

30
Wen Man Make Vow
1All di leaders for di tribe, Moses kon tell dem about Israel pipol sey, “Dis na wetin God kommand: 2‘If man make vow give God or take ensef take swear, e must nor break am, but e go do wetin e tok.
Wen Woman Make Vow
3“ ‘If yong woman wey still dey stay en papa house make vow give God or promise with ensef 4and en papa hear en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. 5But if en papa nor gri make e do wetin e vow wen e hear am, God go forgi-am, bikos en papa nor gri make e do am.
Wen Wife Make Vow
6“ ‘If woman wey neva marry make vow, weda e know or e nor know, or promise and fail, den e kon marry, 7if di husband hear about en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. 8But if di husband nor gri make e do wetin e vow, God go forgi-am.
Woman Wey En Husband Don Die Vow
9“ ‘Woman wey en husband don die or dem nor dey togeda again, must do wetin e vow or promise.
10“ ‘If woman wey don marry make vow or promise, 11if di husband hear am and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. 12But if en husband nor gri make e do wetin e vow or promise, e fit nor do am and God go forgi-am, bikos na en husband nor gri make e do am. 13So en husband get di rite to gri or nor gri make e do wetin e vow or promise. 14But if di day afta e hear about di vow, e nor tok anytin, e must do evritin wey e vow or promise and since e nor tok anytin for di day wen e hear about am, e don agri with di vow wey di woman make. 15But if leta e nor gri make e do wetin e vow, e go sofa, bikos e nor allow am do wetin e vow.’ ”
16Dis na di law wey God give Moses about vow wey koncern, man and en wife; and about papa and en dota wey dey di same house.

Actualmente seleccionado:

Nombas 30: pcm

Destacar

Copiar

Comparar

Compartir

None

¿Quieres tener guardados todos tus destacados en todos tus dispositivos? Regístrate o inicia sesión