Logo de YouVersion
Icono de búsqueda

Nombas 29

29
Blow Di Trumpet
1“ ‘For di first day for di sevent mont, una go gada woship mi. Una must nor do any work, bikos dat na di day wey dem go blow trumpet for una. 2Make una give burnt ofrin to God, di smell wey God go like: make una give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay. 3Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu; two kilogram with di ram, 4and one kilogram with each lamb. 5Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy. 6Make una give dis plus di normal burnt ofrin for di first day for di mont with en korn ofrin; di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin. Dis food ofrin get betta smell wey God like well-well.
Day To Pray For Forgivenes
7“ ‘Make una gada woship God for di tent day for di sevent mont and make una nor chop food or do any work. 8But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay. 9Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu, two kilogram with di ram, 10and one kilogram with each lamb. 11Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy and una go still give di evriday burnt ofrin with en korn ofrin.
Di Feast For Where Una Dey Stay Naw
12“ ‘Make una gada woship God for di fifteent day for di sevent mont. Una go do dis to take honor God for seven days and una nor go do any work. 13For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay. 14Make una give di rite korn ofrin wey bi flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with each ram, 15and one kilogram with each lamb. 16Make una still give one goat as sin ofrin. Give dis plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
17“ ‘For di sekond day, make una give twelf yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay. 18Una go still give dia grain and wine ofrin with di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 19Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
20“ ‘For di third day, una go give eleven melu, two ram, fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 21with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 22Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
23“ ‘For di fourt day, make una give ten melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 24with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 25Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
26“ ‘For di fift day, make una give nine melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 27with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 28Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
29“ ‘For di sixt day, make una give eight melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 30with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 31Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
32“ ‘For di sevent day, make una give seven melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 33with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 34Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
35“ ‘For di eight day, make una gada woship and nor do any work. 36Make una give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay, 37with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok. 38Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
39“ ‘Dis na di law for burnt, grain, wine and fellowship ofrin wey una go give God wen una dey do di feast. Dis ones join di ofrin wey una go give to fulfil di vow or as free will ofrin.’ ”
40So Moses tell Israel pipol evritin wey God kommand am.

Actualmente seleccionado:

Nombas 29: pcm

Destacar

Copiar

Comparar

Compartir

None

¿Quieres tener guardados todos tus destacados en todos tus dispositivos? Regístrate o inicia sesión