Nombas 31
31
Midian War
1God tell Moses: 2“Make yu ponish Midian pipol, bikos of wetin dem do Israel pipol. Afta yu don do am, yu go die.”
3So Moses tell di pipol, “Make una ready for war, so dat una go fit attack Midian pipol kon ponish dem for wetin dem do God pipol. 4From each tribe wey dey Israel, make una send 1,000 men go war.” 5So dem kon choose 1,000 men from each tribe and all di men wey ready for war, na 12,000.
Komplain About Midian Pipol
6So Moses send dem go war and na Finehas wey Eleazar di priest born bi dia leader. Na dis Finehas dey kare for di holy tins and di trumpet wey dem take dey give sign.
7Dem attack and kill all di men for Midian, just as God kommand Moses. 8Dem kill di five kings for Midian wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba. Dem still kill Balaam wey Beor born. 9Israel pipol katch all di wimen and shidren for Midian kon karry all dia animals, propaty 10den dem burn dia towns and kamps. 11Dem take all dia propaty, plus di prisonas and animals 12go give Moses, Eleazar and Israel pipol near di kamp for Moab wey dey di oda side for Jordan River near Jeriko. 13Moses, Eleazar and all di oda leaders for di kommunity kon komot from di kamp go meet di sojas.
Midian Wimen
14Moses vex with di ofisas and di leaders wen dem kom back from di war. 15So e ask dem, “Why una nor kill all di wimen? 16Remember sey na dis wimen obey wetin Balaam tok for Peor kon make di pipol sin against God. Dat na wetin curse wahala for God pipol. 17So naw, make una kill all di boys and wimen wey don sleep with man, 18but nor kill di girls and wimen wey neva sleep with man before.
Wen War Di End
19“Naw all of una wey don kill pesin or wey tosh dead body go stay outside di kamp for seven days and for di third and sevent day, make una and di wimen wey una katch klean unasef. 20Make una klean all una klot and evritin wey dem make with leda, goat hair, or wood.” 21Eleazar di priest kon tell di men wey kom back from war sey, “Dis na di law wey God give Moses: 22‘Na only di gold, silva, bronze, iron, tin, lead 23and evritin wey go fit pass thru fire, naim una go put for fire, so dat dem go dey holy, but anytin wey una nor fit put for fire, una go-go wosh am with wota. 24Una must wosh una klot for di sevent day and una go dey holy, den una go fit enter di kamp.’ ”
Dem Share Di Propaty
25Den God tell Moses: 26“Make yu, Eleazar and di leaders take di propaty wey dem karry, both pipol and animals 27kon share di propaty into two. One for doz wey go fight di war and di oda one for di whole kommunity. 28From di sojas own, make yu take God tax komot; one from evry five hundred prisona and na di same tin for di animals. 29Make yu give Eleazar all of dem as special ofrin to God. 30From di ones wey dem give di oda pipol, make yu take one from evry fifty prisona and na di same tin for di animals. Yu go give all of dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako.” 31So Moses and Eleazar kon do wetin God kommand. 32All di good tins wey remain from di propaty wey di men wey go war karry, na 675,000 sheep; 33dem still karry 72,000 kattle, 3461,000 donkey, 35plus 32,000 wimen wey neva sleep with man at-all. 36Di half wey dem share give di sojas
na 337,500 sheep; 37God tax for di sheep na 675.
38Di kattle wey dem kount na 36,000; God tax na 72.
39Di donkey na 30,500; God tax na 61.
40Di pipol kon bi 16,000, so God tax na 32 pipol.
41So Moses give di tax wey bi God special ofrin to Eleazar di priest, just as God kommand am. 42Wetin dem share give di kommunity na di same tin with wetin dem give di sojas. 43So dem share 337,500 sheep kon give dem to di kommunity, 4436,000 kattle, 4530,500 donkey 46and 16,000 pipol. 47From evritin wey dem share give di kommunity, Moses take one from evry fifty kon give dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako, just as God kommand.
48Den di ofisas wey dey kommand di soja kon go meet Moses 49sey, “Oga God, wi don kount all di sojas wey dey under awa kommand and dem komplete. 50So wi dey bring di gold ornaments, armlets, bracelets, rings, ear-rings and necklaces wey each of us take. Wi give dem to God as payment for awa life, so dat E go protet us.”
51Moses and Eleazar kon take all di gold as ornament. 52All di gold wey di ofisas give to God heavy rish 16,750. 53Each soja don take propaty for ensef. 54So Moses and Eleazar di priest kon take di gold from di ofisas go di tent, so dat God go protet Israel pipol.
Actualmente seleccionado:
Nombas 31: pcm
Destacar
Copiar
Comparar
Compartir
¿Quieres tener guardados todos tus destacados en todos tus dispositivos? Regístrate o inicia sesión
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee