Zekaraya 6
6
Four War Horse
1I look up again and dis time, I si four shariot dey kom out from di centre for two bronze mountin. 2Na red horses dey drag di first shariot, while black horses dey drag di sekond shariot. 3Na white horses dey drag di third one and na horses wey get spots for body dey drag di fourt one. 4Den I ask di angel wey dey tok to mi, “My oga! Na wetin dis shariot dem mean?” 5E ansa, “Dis na di four spirit for heaven wey dey stand for God wey kreate di world front.” Dem dey go do en work. 6Di shariot wey di black horse dey drag, dey go nort; di white horse dey go west and di horse wey get spots dey go di kountries for sout. 7As di strong horse dem kom out, dem rush dey go patrol di eart. Di angel kon tell dem, “Make una go patrol di eart well-well!” So dem kon go. 8Den Oga God koll and tell mi, “Si, di shariot wey go di nort side don make mi stop to vex for di pipol for di land.”
Dem Crown Joshua
9God give mi dis message: 10“Make yu take Heldai, Tobaya and Jedaya wey kom back from Babilon with di oda pipol, den go meet Josaya wey bi Zefanaya pikin for en house. 11Yu go use di silva and gold wey dem bring as gift take make crown, den crown Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest. 12Make yu tell am, ‘God wey get pawa sey, “Dis na di man wey dem dey koll di Branch, e go prosper kon build God temple again. 13Naim go build di temple kon take di praiz wey suppose bi di king own and e go rule en pipol. One priest go stand near en throne and dem go work togeda with peace and undastandin. 14Na di crown dem go take honor and remember Heldai, Tobijah, Jedaya and Josaya for God temple. 15Pipol from far go kom join build God temple again. And wen dem don build am finish, yu go know sey na God wey dey mighty send mi kom meet yu. All dis tins go happen if yu use yor whole heart take obey all wetin di Oga yor God kommand yu.” ’ ”
Právě zvoleno:
Zekaraya 6: pcm
Zvýraznění
Sdílet
Kopírovat
Chceš mít své zvýrazněné verše uložené na všech zařízeních? Zaregistruj se nebo se přihlas
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: