Zekaraya 2
2
Di Man Wey Measure Jerusalem
1Den I look again kon si one man whole ruler wey dem take dey measure. 2So I ask am, “Where yu dey go?” E ansa, “I dey go measure Jerusalem, make I for know as e wide and long rish.” 3Den di angel wey dey tok to mi kon waka go front and anoda angel kom meet am. 4Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’ 5God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”
6God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere. 7Zion pipol, make una eskape and run komot Babilon! 8Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.” 9God sey, “I go ponish dem well-well and na dia own slave go distroy and pak dia propaty.” Den una go know sey na Oga God wey dey rule ova evritin send mi kom.
10So Zion pipol, make una shaut and happy as una dey sing, bikos I dey kom meet and stay with una.
Dis na wetin Oga God tok.
11For dat time, many nashons go kom meet God and dem go bi en pipol. God go stay with una, den una go know sey na God send mi kom. 12Judah go bi God special propaty for en holy land again, den Jerusalem go bi di town wey God choose. 13So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.
Právě zvoleno:
Zekaraya 2: pcm
Zvýraznění
Sdílet
Kopírovat
Chceš mít své zvýrazněné verše uložené na všech zařízeních? Zaregistruj se nebo se přihlas
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: