Zekaraya 13
13
God Go Klean Judah
1God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do. 2For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again. 3But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
4“For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol. 5Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’ 6Den if pesin ask am, ‘So na who wound yu for yor chest?’ E go ansa, ‘Na my friend house I for wound.’ ”
Di Sheep Dem Skata
7God wey dey mighty sey,
“Swod! Make yu go attack and kill
di shepad wey dey work for mi,
den all di sheep go skata.
I go attack my pipol
8and if dem divide all di pipol
wey dey di land into three,
two part go die finish.
9I go test di third part wey survive kon klean dem,
just as dem dey klean silva for fire.
I go test dem, just as dem dey test gold.
Den dem go pray give mi and I go ansa dem.
I go tell dem sey dem bi my pipol
and dem go sey,
‘Na di Oga bi awa God.’ ”
Právě zvoleno:
Zekaraya 13: pcm
Zvýraznění
Sdílet
Kopírovat
Chceš mít své zvýrazněné verše uložené na všech zařízeních? Zaregistruj se nebo se přihlas
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee