Logo YouVersion
Ikona vyhledávání

Matiu 6

6
Give With Good Mind
1“Make una nor dey do good bikos una wont make pipol si una; if una do so, God nor go pay una for di good wey una do.
2“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward. 3But wen una dey give, make una nor let una left hand know wetin una rite hand give. 4So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
Tishing About Prayer
5“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward. 6But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present. 7Wen una dey pray, make una nor tok one word many times as pipol wey dey serve juju dey do, bikos dem tink sey dia juju go hear dem wen dia tok plenty. 8Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.
9“So make una pray like dis:
“ ‘Awa Papa wey dey for heaven,
wi praiz yor name,
10make yor Kingdom kom,
make wetin yu wont,
happen for dis world as e bi for heaven.
11Give us di food wey wi go chop evriday,
12forgive us all di bad-bad tins wey wi don do,
as wisef dey forgive odas di bad tins wey dem do us.
13Nor allow us enter temptashon,
but make yu save us from bad tins.’
14If una forgive oda pipol di bad tins wey dem do una, una Papa wey dey for heaven go forgive una too. 15But if una nor forgive odas, una Papa sef nor go forgive una.”
Tishing About Fasting
16“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward. 17But wen una dey fast, make una wosh and rub pomade for una face, 18so dat odas nor go know sey una dey fast, but only una Papa wey dey for sekret go know. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
Propaty Wey Dey Last
19“Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem. 20But make una gada betta tins for unasef for heaven, where siti-siti nor go for fit chop dem and dem nor go rust and tif nor go fit enter tif dem, 21bikos, where una propaty dey, na der una heart go dey too.
22“Na eye bi di lite for pesin body. If pesin eye dey okay, lite go full en body. 23But if pesin eye blind, den darkness go full en body. If di lite wey dey inside una na darkness, di darkness big well-well!
24“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
Make Una Nor Worry
25“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot? 26Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem? 27Who among una wey dey worry go fit add one hour join en life?
28“Why una dey worry about klot wey una go wear? Make una tink how flower dey grow for field; dem nor dey work or make klot wey dem dey wear. 29I tell una true word, even Solomon, upon all di money wey e get, e nor wear klot wey fine rish di ones wey dis flower dem dey wear! 30If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o. 31So make una nor worry kon dey sey, ‘Wetin wi go chop, drink or wear?’ 32Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem. 33But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own. 34So make una nor worry about tumoro, bikos tumoro get en own wahala. Today trobol don do.”

Právě zvoleno:

Matiu 6: pcm

Zvýraznění

Sdílet

Kopírovat

None

Chceš mít své zvýrazněné verše uložené na všech zařízeních? Zaregistruj se nebo se přihlas