Logo YouVersion
Ikona vyhledávání

Malakai 1

1
God Love Israel
1Dis na di message wey God give Malakai about Israel pipol.
2God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?”
God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob 3kon rijet Esau, en broda. I distroy Esau hill kountry kon turn dia land to where dem dey trowey dirty put and naw, na wild animals dey stay der.”
4Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ” 5Wen una si all dis tins dey happen, una go sey, “God pawa big well-well both for Israel land and for evriwhere for di world!”
6Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’ 7Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all. 8Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am. 9So, make una beg God, so dat E go favor una. But with dis kind sakrifice wey una dey bring, how E won take ansa una prayers?”
10God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
11God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons. 12But una nor dey respet mi, bikos una sey e dey okay to spoil God altar, so una dey give mi sakrifice wey unasef nor go asept. 13Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una? 14Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”

Právě zvoleno:

Malakai 1: pcm

Zvýraznění

Sdílet

Kopírovat

None

Chceš mít své zvýrazněné verše uložené na všech zařízeních? Zaregistruj se nebo se přihlas