1
Matiu 16:24
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.
Porovnat
Zkoumat Matiu 16:24
2
Matiu 16:18
And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.
Zkoumat Matiu 16:18
3
Matiu 16:19
I go give yu heaven key, so dat anytin wey yor prayer tie for eart, dem go tie am for heaven and anytin wey yor prayer luz for dis eart, dem go luz am for heaven.”
Zkoumat Matiu 16:19
4
Matiu 16:25
Anybody wey won save en life, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.
Zkoumat Matiu 16:25
5
Matiu 16:26
Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
Zkoumat Matiu 16:26
6
Matiu 16:15-16
Jesus kon ask dem, “Who una sey I bi?” Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”
Zkoumat Matiu 16:15-16
7
Matiu 16:17
Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.
Zkoumat Matiu 16:17
Domů
Bible
Plány
Videa