1
Mark 14:36
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Jesus kon pray, “My Papa, e nor get wetin yu nor fit do. Make yu take dis sofa cup from mi. But nor bi as I wont am, but na as yu wont.”
對照
探尋 Mark 14:36
2
Mark 14:38
Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”
探尋 Mark 14:38
3
Mark 14:9
I tell una true word, anywhere wey dem go prish dis gospel for di whole world, pipol go tok about dis tin wey dis woman don do so.”
探尋 Mark 14:9
4
Mark 14:34
E kon tell dem, “My heart dey heavy well-well like sey I won die. So, make una stay here dey wosh.”
探尋 Mark 14:34
5
Mark 14:22
As dem dey chop, Jesus take bread, tank God, den divide am give en disciples kon sey, “Make una take and chop, bikos dis na my body.”
探尋 Mark 14:22
6
Mark 14:23-24
Afta, e take cup, tank God, den e give en disciples and all of dem, drink from inside. E kon tell dem, “Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribody.
探尋 Mark 14:23-24
7
Mark 14:27
Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di pesin wey dey look di sheep and di sheep go skata.’
探尋 Mark 14:27
8
Mark 14:42
Make una get up make wi dey go. Si, di pesin wey won sell mi, dey kom!”
探尋 Mark 14:42
9
Mark 14:30
Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’ two times, yu go don deny mi three times.”
探尋 Mark 14:30
首頁
聖經
計畫
視訊