Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins. Dis still show sey God dey rite wen E asept pipol wey bilive Jesus Christ. E dey ponish sinnas, so dat wi go know sey en na God wey nor like sin. Like dis, God show sey en dey rite and anybody wey bilive Jesus Christ, E dey make dem dey rite too.