Bikos of dis, God leave dem for dia yeye life. Even di wimen shange and dem kon dey do tins wey nor good. And na so too, men nor kon like wimen again, but dem kon dey like to sleep with oda men. So, God ponish dem bikos of wetin dem dey do.
Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.