1
Jenesis 17:1
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
Сравнить
Изучить Jenesis 17:1
2
Jenesis 17:5
Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons.
Изучить Jenesis 17:5
3
Jenesis 17:7
“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
Изучить Jenesis 17:7
4
Jenesis 17:4
“I make dis kovenant with yu: I promise sey yu go bi many pipol papa.
Изучить Jenesis 17:4
5
Jenesis 17:19
But God sey, “No! Yor wife Sarah go get belle kon born boy for yu and yu go koll am, Isaak. I go keep my kovenant with am and en shidren-shidren forever. Di kovenant na forever and ever.
Изучить Jenesis 17:19
6
Jenesis 17:8
I go give yu and yor shidren dis land where yu dey stay as strenja naw. Di whole Kanaan land go bi yor shidren-shidren own forever and I go bi dia God.”
Изучить Jenesis 17:8
7
Jenesis 17:17
Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”
Изучить Jenesis 17:17
8
Jenesis 17:15
God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah.
Изучить Jenesis 17:15
9
Jenesis 17:11
From naw go, yu must sekonsaiz evry pikin wey bi boy, eight days afta dem born am
Изучить Jenesis 17:11
10
Jenesis 17:21
But I go keep my kovenant with yor pikin Isaak, wey Sarah go born for dis time next year.”
Изучить Jenesis 17:21
11
Jenesis 17:12-13
plus yor savant wey bi strenja shidren wey dem go born for here. Dis go show sey mi and yu, get kovenant. Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever.
Изучить Jenesis 17:12-13
Главная
Библия
Планы
Видео