Logo de YouVersion
Icono de búsqueda

Nombas 34

34
Di Land Borda For Sout
1Den God tell Moses: 2“Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen una enter Kanaan land and evriwhere wey I promise to go give una; 3den di borda for sout go start from Zin Wildaness go rish di borda for Edom. Una sout borda go face east go rish di Salt Sea. 4Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon, 5where e go for turn face di valley wey dey Egypt borda and Mediterranean Sea.
Di Land Borda For West
6“ ‘Di borda for west go bi di Mediterranean Sea.
Di Land Borda For Nort
7“ ‘Dis go bi una borda for nort: Una go draw line from Mediterranean Sea go Mount Hor 8and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad. 9Di borda go kontinue rish Zifron kon end for Hazar-Enan. Dis go bi una nort borda.
Di Land Borda For East
10“ ‘For di borda for east: Una go draw line from Hazar-Enan go Shefam. 11Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea. 12Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.” 13So Moses tell Israel pipol, “Dis na di land wey una go get thru dice wey dem trow. God don give di land to di nine and half tribes. 14Bikos Reuben, Gad and half for Manasseh tribe wey kom from east, don get dia propaty 15for di east side for Jordan River near Jeriko.”
Moses Choose Ofisas
16God tell Moses, 17“Eleazar di priest and Joshua wey Nun born go divide di land for di pipol. 18So make yu take one leader from each tribe, so dat dem go help divide am too. 19Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born; 20from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born; 21from Benjamin tribe, e pick Elidad wey Kislon born; 22from Dan tribe, e pick Bukki wey Jogli born; 23from Josef tribe, e pick Hanniel wey Efod born and na leader for Manasseh tribe; 24from Efraim tribe, e pick Kemuel wey Shiftan born; 25from Zebulun tribe, e pick Elizafan wey Parnak born; 26from Issakar tribe, e pick Paltiel wey Azzan born; 27from Asher tribe, e pick Ahihud wey Shelomi born; 28from Naftali tribe, e pick Pedahel wey Ammihud born.” 29Dis na di ones wey God kommand to divide di propaty among Israel pipol wey dey Kanaan land.

Actualmente seleccionado:

Nombas 34: pcm

Destacar

Copiar

Comparar

Compartir

None

¿Quieres tener guardados todos tus destacados en todos tus dispositivos? Regístrate o inicia sesión