YouVersion 標識
搜索圖示

Mark 8

8
Jesus Feed For Tazon Pipol
1Dat time, plenty pipol gada and nor-tin dey for dem to chop. So Jesus koll en disciples tell dem, 2“I dey sorry for dis pipol, bikos dem don dey here with mi for three days naw and dem nor get anytin to chop. 3If I send dem go with honga, dem go faint for road and some kom from far place.”
4Jesus disciples kon sey, “Where pesin go fit si bread buy wey go rish dis pipol chop, since pipol nor dey stay dis place wey bi wildaness?”
5Jesus ask dem, “How many bread una get?”
Dem ansa, “Na seven.”
6Den Jesus sey make di pipol sidan for groun. Afta e take di seven bread tank God, e kon divide am give en disciples, sey make dem share am for di pipol. 7Dem still get some small-small fish too and afta Jesus don tank God, e kon tell en disciples make dem share am for di pipol too. 8Evribody chop beleful and di ones wey dem gada, full seven basket. 9All di pipol wey chop rish 4,000 men. Den, Jesus kon send dem go house. 10En and en disciples kon enter boat go Dalmanuta aria.
Pipol Ask For Sign
11Di Farisee pipol kon dey argue with Jesus sey make e show dem sign from heaven, bikos dem won try am. 12Jesus kon ask dem, “Why pipol for dis world naw dey ask for sign? Make I tell una true word, dem nor go get any sign.” 13Den e kon leave dem enter boat go di oda side.
Herod And Di Farisee Pipol Yist
14Jesus disciples forget to take bread join di ones wey dey with dem inside di boat. 15Jesus kon tell dem, “Make una shine una eye, so dat una go guide unasef against di Farisee pipol and Herod yist!”
16So, dem kon dey tok to each oda about di bread wey dem nor take follow body.
17Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Why una dey tok about bread wey una nor take? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish? 18Una get eye, but una nor fit take am si? Una get ear, but una nor fit take am hear? Una nor dey remember anytin at-all? 19Wen I divide five bread for 5,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?”
Dem ansa, “Na twelf.” 20“Den, wen I divide seven bread for 4,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?”
Dem ansa, “Na seven.”
21Den Jesus tell dem, “Una neva still undastand?”
Jesus Heal Blind Man For Betsaida
22Wen dem rish Betsaida, dem bring one man wey nor dey si kom meet Jesus make e tosh am. 23E hold di man for hand kon take am go outside di village. Jesus spit for di man eye kon tosh am, den ask am, “Yu dey si anytin?”
24Di man look up kon sey, “Yes, I dey si pipol, but dem bi like tree wey dey waka about.”
25Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well. 26E kon tell di man make e dey go en house, but e warn am sey, “Make yu nor go inside di village again.”
Pita Tok Who Jesus Bi
27Jesus and en disciples kon go di village dem wey dey Caesaria Filippi. As dem dey go for road, e kon ask en disciples, “Na who pipol dey sey I bi sef?”
28Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey, yu bi Elijah and some still sey, yu bi one for di profets.”
29Jesus ask dem again, “But who una sey I bi?”
Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya.”
30Den e warn dem make dem nor tell anybody who e bi.
Jesus Deat And Resureshon
31Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.” 32As e nor hide dis tins from dem, Pita koll am go korna kon tell am, “Wetin yu dey tok so nor good o-o.”
33But Jesus turn look en disciples kon shaut for Pita, “Satan! Make yu go my back, bikos yu nor put yor mind for wetin God wont. Na wetin human being wont, na der yor mind dey.”
How To Follow Jesus
34Den Jesus koll di pipol with en disciples kon tell dem, “If anybody one follow mi, e must deny ensef, karry en cross, den kon follow mi. 35Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi and dis gospel, go save am. 36Wetin pesin go gain if e get di whole world and e luz en soul? 37Wetin pesin fit use take eschnage for en life? 38If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”

目前選定:

Mark 8: pcm

醒目顯示

分享

複製

None

想要在所有設備上保存你的醒目顯示嗎? 註冊或登入