YouVersion 標識
搜索圖示

Mark 11

11
Jesus Enter Jerusalem
1As Jesus and en disciples won enter Jerusalem, dem kon rish Betpage and Betany wey near Mount Olives, so Jesus send en two disciples go for dia front 2kon tell dem, “Make una go di village wey dey for front. As una enter, una go si one small donkey wey dem tie for der, wey anybody neva ride before. Make una luz am kom. 3If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una sey, ‘Di oga nid am naw. Wi go bring am back leta.’ ”
4So dem go kon si small donkey wey dem tie near one door for road and dem kon luz am. 5Some pipol wey stand for der kon ask dem, “Why una dey luz dat small donkey?” 6Dem kon tok as Jesus sey make dem tok, so di pipol kon let dem go. 7Dem bring di small donkey kom meet Jesus kon spread dia klot on-top am, den Jesus kon sidan put. 8Many pipol spread dia klot for road and some oda pipol spread palm leafs wey dem kut from bush. 9Di pipol wey dey front and di ones wey dey follow am for back kon dey shaut,
“Hosanna!
God don bless di King wey dey kom with en name.
10God don bless awa papa David kingdom wey dey kom.
Hosanna, wi hail o-o!”
11Jesus enter Jerusalem kon go inside di temple. Afta e don look evritin wey dey der, e kon go Betany with en twelf disciples, bikos day don dey dark.
Jesus Curse Di Fig Tree
12Di next day, as dem dey komot for Betany, Jesus kon dey hongry. 13E si one fig tree from far wey get plenty leafs, so e kon waka go look weda fruit dey for di tree. Wen e rish der, e si sey nor-tin dey di tree, na only leafs e get, bikos fig sizin neva rish. 14E kon tell di tree, “Pipol nor go ever chop yor fruit again.” And en disciples hear wetin e tok.
Jesus Klean Di Temple
15Wen dem rish Jerusalem, Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell and buy for di temple varanda. E trowey di pipol wey dey shange money tabol and di pipol wey dey sell bird, e trowey dia chair too. 16Jesus nor let anybody take anytin wey dem dey sell pass di temple varanda. 17Den e tell dem, “Dem rite am sey,
“ ‘Pipol go koll My house,
Prayer house for di whole world.’
But una don turn am to where tif dey stay.”
18Wen di priest oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan how dem go take kill Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.
19Wen evening rish, Jesus and en disciples kon komot for di town.
Di Fig Tree Die
20For morning, wen Jesus and en disciples dey pass, dem kon si sey di fig tree don dey die from en rut. 21Pita remember kon tell Jesus, “Tisha, look! Di fig tree wey yu curse yestiday don die.”
22Jesus tell dem, “Make una get faith for God. 23I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am. 24Na dis make mi dey tell una sey, anytin wey una pray and ask God for, make una bilive sey una don get am and e go bi una own. 25Anytime una dey pray, if una get anytin for mind against anybody, make una forgi-am, so dat una Papa wey dey heaven go forgive una too. 26But if una nor gri forgive oda pipol, una Papa wey dey heaven nor go forgive una.”
Kweshon About Jesus Authority
27Jesus and en disciples go Jerusalem again. Wen Jesus dey waka for di temple varanda, di priest oga dem, di law tishas and di eldas kom meet am sey, 28“Na wish rite yu get to take dey do all dis tins? Who give yu di pawa?”
29Jesus ansa dem, “I go ask una one kweshon. If una ansa mi, den I go tell una wish rite I get to dey do dis tins. 30John baptizim, na from God, abi na from pipol e from kom? Make una ansa mi.”
31Dem kon dey tok to each oda, “If wi sey, ‘Na from God,’ e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’ 32But wi nor fit sey, ‘Na from pipol.’ ” bikos wi dey fear dis pipol, (since dem bilive sey John na profet).
33So dem ansa Jesus, “Wi nor know.”
Den, Jesus sey, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”

目前選定:

Mark 11: pcm

醒目顯示

分享

複製

None

想要在所有設備上保存你的醒目顯示嗎? 註冊或登入