Matiu 25
25
Di Ten Virgins Parabol
1“God Kingdom bi like wen ten virgins karry dia lamps go meet man wey won marry wife. 2Five get sense and five nor get sense. 3Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body. 4But di ones wey get sense karry estra kerosine. 5E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.
6“For mid-nite, somebody kon shaut, ‘Make una wake-up, di man wey won marry, dey kom o-o! Make una kom meet am.’
7“So all di virgins wake-up, kon inkrease dia lite. 8But di ones wey nor get sense kon tell di wise wons sey, ‘Make una give us some kerosine, bikos awa lite won kwensh.’
9“But dem ansa, ‘No! Wetin wi get nor go rish wi share, instead make una go buy for unasef.’
10“Wen dem go buy, di man wey won marry kon kom and di ones wey dey ready kon enter di party with am and dem kon lock di door.
11“Afta, di oda virgins kom back dey sey, ‘Oga God, Oga God! Make yu allow us enter.’
12“But e ansa dem, ‘No! I nor know una!’
13“So, make una dey ready, bikos una nor know di day or time wen Christ go kom.”
Di Talent Parabol
14“One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem. 15E give one five koins, give anoda one two koins and di last, one koin. E give each savant wetin e go fit use, den e kon travel. 16Di savant wey get five koins kwik-kwik go use en money trade kon gain five koins join wetin e get. 17Di same way, di savant wey get two koins, gain two estra koins join en own. 18But di savant wey get one koin kon go dig hole for outside, hide di money wey en oga gi-am.
19“Afta, dia oga kon kom back make e for know how dem use di money wey e give dem. 20Di savant wey e give five koins, kon bring anoda five koins join en own, sey, ‘Oga God yu give mi five koins. Si, I don gain five koins join dem.’
21“En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’
22“Di one wey dem give two koins still sey, ‘Oga God yu give mi two koins. Si, I don get two koins join dem.’
23“En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’
24“Den di savant wey e give one koin kon sey, ‘Oga God, I know sey yu bi wayo man, yu dey harvest wetin yu nor plant and dey pak fruits wey yu nor plok, 25so fear katch mi and I kon hide yor money for groun. So oga, make yu take wetin yu give mi.’
26“En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok, 27yu for put my money for bank, so dat wen I kom back, I go kollect my money back with intrest!
28“ ‘Make una take di money from am and gi-am to di savant wey get ten. 29Bikos di pesin wey get sometin go get more and wetin e get, go plenty. But di pesin wey nor get, even di small one wey e get, dem go take am from am. 30Make una trow dat wiked savant inside darkness for outside, where e go kry and grind en tit.’
Di Judgement
31“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne. 32Evribody for di world go gada for en front and e go separate pipol as shepad dey separate sheep from goat. 33E go keep di sheep for en rite hand and di goat for en left.
34“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start. 35Wen I dey hongry, una give mi food, wen I dey thirsty, una give mi sometin drink and wen I bi strenja, una let mi enter una house. 36I dey naked and una give mi klot wear, wen I nor well, una kare for mi, wen I bin dey prison, una kom visit mi.’
37“Den di raitious pipol go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu hongry and dey thirsty, kon feed and give yu sometin drink? 38Wish time wi si yu as strenja, kon take yu enter awa house, or naked, kon give yu klot wear? 39Wish time wi si yu wen yu nor well or dey for prison kon visit yu?’
40“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
41“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels. 42Bikos di time wey I dey hongry and thirsty, una nor give mi food and wota drink. 43Di time wen I bi strenja, una nor let mi enter una house, wen I dey naked, una nor give mi klot wear, wen I nor well and dey for prison, una nor kom visit mi.’
44“Den, dem go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu dey hongry or won drink and wi nor give yu food or sometin to drink, wish time yu bi strenja or naked or nor well or dey for prison and wi nor give yu wetin yu wont?’
45“Den, di king go ansa dem, ‘I tell una true word, just as una nor do am for di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una nor do am for mi.’
46“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee