Matiu 19

19
Divorce
1Wen Jesus tok finish, e kon komot from Galilee go Judea aria for di oda side for Jordan River. 2Plenty pipol follow am and e heal all of dem.
3Some Farisee pipol kom test and ask am sey, “E dey rite for man to drive en wife at-all?”
4Jesus ansa, “Yu neva read am from di biginnin sey na man and woman God make 5and bikos of dat, ‘Man go leave en papa and mama go join en wife and di two of dem go kon bi one?’ 6Dem nor bi two again, but one. So, wetin God don join togeda, make nobody skata am.”
7Di Farisee pipol ask am again, “Wetin make Moses sey make wi drive awa wife?”
8Jesus ansa, “Moses sey make una drive una wife, bikos una heart dey wiked, but nor bi so God plan am from biginnin. 9Naw I tell una, anybody wey drive en wife, wey nor bi sey e sleep with anoda man, but kon marry anoda woman, don kommit adultery.”
10Di disciples kon tell Jesus, “If na so husband and wife matter bi, e betta make pesin nor marry at-all?”
11Jesus ansa dem, “Nor bi evribody go fit asept dis word, but na only di pipol wey God give di pawa. 12Many men nor fit sleep with woman, bikos na so dem born dem, some na human being do dem like dat, but odas na bikos of God Kingdom. Anybody wey fit asept wetin I tok, make e take am like dat.”
Jesus And Small Shidren
13Some pipol bring shidren kon meet Jesus make e put hand for dia head pray for dem. But di disciples kon bigin kworel with di pipol wey bring di shidren.
14But Jesus tell di disciples, “Make una leave di small shidren make dem kom meet mi, nor stop dem, bikos na dem get God Kingdom.” 15So e put en hand for dia head, bless dem, den e waka komot der.
Di Yong Man Wey Get Money
16One man kom meet Jesus, ask am, “Tisha, wish good tin I go do make I for fit enter God Kingdom?”
17Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”
18Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?”
Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si, 19respet yor papa and mama and make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
20Di yong man ansa, “I dey obey all dis law with my heart. Wetin still remain wey I go do?”
21Jesus tell am, “If yu won dey pafet, go sell evritin wey yu get, den give di money to poor pipol and yu go get betta tins for heaven. Wen yu don do wetin I tok, den make yu kom follow mi.”
22Wen di yong man hear wetin Jesus tok, e vex waka komot, bikos e get money well-well.
23Den Jesus tell en disciples, “I tell una true word, e go hard for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom! 24Again, I dey tok sey, e go eazy for kamel to pass thru nidol whole, dan for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom.”
25Di disciples sopraiz wen dem hear dis tins and dem kon ask, “Den who go fit dey save?”
26Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
27Den Pita kon tell Jesus, “Look, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu! Wetin dey for us naw?”
28Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel. 29And anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa or mama and land bikos of mi, go get am back hundred times and e go get life wey nor dey end. 30So many pipol wey bi first naw, go bi last and doz wey bi last, go bi first.”

目前选定:

Matiu 19: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录