Hibru Introdushon

Introdushon
Nobody really know who rite dis book or who e rite am to. Di book show en sey main audience na Jew pipol wey dey stay for foreign kountries and dem bilive Jesus Christ. Dem bi pipol wey speak Greek as dia main language but wey dia faith for Jesus kon dey shake, bikos of di suffer wey dem dey esperience. Di book show how di new kovenant wey God bring thru Jesus Christ betta pass di former one wey Moses law tish. Di pesin wey rite am enkourage di bilivers sey make dem nor fear but make dem get faith for di life wey dey inside Jesus.
Di main kontribushon wey di book make to di New Testament bi sey, e show how Jesus Christ fulfil all di tins wey di Temple, sakrifice and priesthood for di Old Testament stand for. Doz tins na di shadow wey point to di real tins wey God plan for humanbin.

目前选定:

Hibru Introdushon: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录