Galatians 5:19-21
Galatians 5:19-21 PCM
Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!





