Acts 9

9
How Saul Take No Jesus Christ
1As all dis tins dey happen, Saul still dey tell di disciples sey e go kill dem. E go meet di High Priest 2kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem. 3As e dey go, one lite from heaven kon shine round where e dey. 4E fall for groun kon hear one vois wey koll en name, “Saul, Saul, wetin make yu dey ponish mi?” 5So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish! 6Naw, make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.” 7Di men wey dey follow am travel, sopraiz dey look, bikos dem hear vois dey tok, but dem nor si anybody. 8So Saul get up from groun, en eye open, but e nor dey si. En friends hold en hand kon escort am enter Damaskus. 9E nor si at-all for three days and for dat time, e nor chop or drink anytin.
10Dat time, e get one disciple for Damaskus and en name na Ananias. God koll am for inside vishon, “Ananias”, e kon ansa, “Na mi bi dis, Oga God.” 11God tell am, “Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der, make yu look for one man, en name na Saul and e kom from Tarsus. Yu go meet am dey pray for der. 12I don show am for vishon sey one man wey dem dey koll Ananias go kom meet am and e go put hand for en head, pray for am, make e for fit si again.” 13But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem. 14E even kollect leta from di priest oga dem, wey e go take katch and trow pipol wey bilive yu, for prison.” 15But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol. 16True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.” 17So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.” 18At wons, sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si. E get up and dem baptize am. 19Afta e chop finish, en body kon strong again and Saul kon stay Damaskus for some days with di disciple.
20At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin. 21Evribody wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, “Dis nor bi di man wey dey kill pipol wey bilive Jesus Christ? Wi tink sey e kom here kon arrest pipol karry go give di priest oga dem.” 22But Saul still dey prish with pawa. E dey show sey na Jesus Christ bi di Mezaya and di Jew pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am.
How Saul Take Komot from Damaskus
23Afta some days, di Jew pipol kon dey plan to kill-am, 24but Saul hear wetin dem dey plan. Some pipol dey wosh for di town gate day and nite make dem for fit kill-am wen dem si am. 25But one nite, di pipol wey dey follow Saul kon put am for basket, trow am down small-small from one small window wey dey near di town fence.
Saul Go Back To Jerusalem
26Wen e rish Jerusalem, e kon try to join di disciples, but dem dey fear am, bikos dem nor bilive sey e don bi Jesus Christ disciple. 27So Banabas take Saul go meet di apostles, den e tell dem how Saul take si Jesus Christ for vishon wen e dey go Damaskus and how e bigin prish with boldness about Jesus Christ. 28Saul stay and waka with dem for Jerusalem and e dey tok with boldness about Jesus Christ. 29E bigin dey tok and argue with di Jew pipol wey dey speak Greek, but some pipol kon dey try to kill-am. 30Wen di brodas know about wetin dem dey plan, dem kon take am go Caesaria and from der, dem send am go Tarsus.
31Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
Pita Heal Aeneas
32Pita dey travel from one place go anoda and e still go where di bilivers dey for Lydda. 33E kon meet one man for der, en name na Aeneas wey nor fit waka since wen e bi eight years. 34Pita kon tell am, “Aeneas, Jesus Christ, wey bi di Mezaya, won heal yu naw. So make yu stand up, karry yor bed!” At wons, e get up kon karry en bed. 35All di pipol wey dey Lydda and Sharon si wetin happen and dem kon bigin follow Jesus Christ.
Pita Wake Dorkas From Deat
36One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol. 37E sick and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead body, dem kon karry am put for one room for upstair. 38Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.” 39So Pita get up follow dem and wen e rish der, dem kon take am go di room for up. All di wimen wey dia husband don die stand near Pita dey kry and dey show am all di dress wey Dorkas make for dem, wen e dey with dem. 40But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan. 41Pita kon hold en hand stand up. E koll di bilivers and all di wimen wey dia husband don die, kon give di woman to dem. 42Wen evribody for Joppa hear dis tin wey happen, many of dem kon bilive Jesus Christ. 43Pita kon stay for Joppa for many days with one man wey dem dey koll Simon, wey dey do leda work.

目前选定:

Acts 9: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录