Acts 27

27
Paul Go Rome
1Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group. 2Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika, follow us. 3Di next day, wi enter Sidon and Julius kon do good give Paul, e allow am go meet en friends make dem fit gi-am all di tins wey e nid. 4From der, wi enter wota travel again face Cyprus island, bikos breeze dey blow di ship. 5Afta wi don travel enter di open sea wey dey inside Silisia and Pamfilia, wi kon stop for Myra, wey dey Lycia. 6For der, di soja kommander kon si one ship wey kom from Alexandria dey drive go Italy and e kon put us for inside. 7Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus. Bikos di breeze nor make us fit go front again, wi kon drive small-small dey go Krete, wey dey opposite Salmone. 8Before wi rish Krete wotaside, e hard us well-well and wi kon rish one place wey dem dey koll, “Fair Havens” wey dey near Lasea town.
Heavy Breeze Whole Us
9As e bi sey time don go well-well and di journey don hard like dis, bikos di time wey dem dey fast don pass, Paul kon advise dem sey, 10“My pipol, I dey si sey dis journey na with wahala e go take end and nor bi only di load and di ship go lost, but many pipol go die too.” 11But di kommander nor listin to am and na wetin di kaptain and di ship owner tok, naim e bilive. 12Bikos di place where ship dey pak put wen dem si, nor good for kold weda; some for di pipol kon gri sey make wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix, wey dey Krete, wey face sout-west and nort-west, so dat wi go fit spend kold sizin for der. 13Wen one kind kwayet breeze blow kom from sout, dem tink sey dem go fit do wetin dem plan, so dem kon dey go small-small pass Krete wotaside. 14Afta di kold breeze, one strong breeze wey dem dey koll, “Hurricane”, kon dey blow kom from di Island. 15Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again, wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like. 16As wi dey run go hide under one small island wey dem dey koll Kauda, nor bi small wahala, before wi fit kontrol di ship. 17Afta dem don drag di ship komot from di wota, dem kon take rope tie am. Wi dey fear sey wi go run around for Sirtis, so wi hook di ship for groun kon leave di breeze make e karry us go. 18Di next day, bikos di breeze worry us well-well, wi kon dey trow awa load put for wota 19and wen di third day rish, dem use dia hand trow wetin dem take dey kontrol di ship put for wota. 20Wen wi nor si sun or star for many days and di breeze still dey worry us, wi kon luz hope sey wi don die bi dat.
21Afta dem don stay without food for many days, Paul stand for dia front kon sey, “My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala. 22Naw, I won make una heart strong, bikos nobody go die among us, but na only di ship go skata. 23Bikos yestiday nite, God wey I dey serve, en angel appear to mi 24kon sey, ‘Make yu nor fear Paul! Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’ 25So, my pipol, make una heart strong, bikos I bilive sey na as God tell mi, na so e go bi. 26But wi sure sey wi go rish land.”
27Afta fourteen days, as di breeze dey karry us pass di Adriatik Sea for mid-nite, di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land. 28Dem trow long rope wey dem tie sometin put inside di wota to measure how e deep rish and dem si sey di wota still deep rish 40 metres. Afta e don tey small, dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres. 29Dem dey fear sey di ship go jam rock for di land, so dem trow for big-big shain from di ship back kon dey pray make day kwik break. 30Den di sailor try to run leave di ship, dem take di small boat for di ship, put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big shain down for di ship front, 31but Paul tell di offisa and sojas, “Unless all dis men stay inside di ship, all of us go die.” 32So di sojas kon kut di rope for di boat make e float go.
33As day one break, Paul enkourage dem make dem chop kon sey, “Today make am fourteen days wey una dey worry, sotey una nor gri chop. 34So naw, I dey beg una to chop, bikos una nid am to survive. And nobody among una go luz even one hair for en head.” 35Wen Paul tok finish, e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop. 36All of dem get strong heart kon take food chop. 37(Wi bi 276 wey dey inside di ship.) 38Wen dem don chop beleful, dem kon trowey all di remainin bread inside di wota make di ship nor for heavy again.
Di Ship Skata
39Wen day break, dem nor know where dem dey, but dem si one small land wey near di sea and dem tok for dia mind sey, if e dey possibol dem go use di ship take enter di land. 40So dem kut all di shains wey whole di ship kon let dem fall inside di sea. Dem still luz di ones wey dey whole wetin dey kontrol di ship. Dem let breeze blow di ship go front and wi kon move face land. 41But dem meet san-san for di sea. So di ship front kon hook and e nor fit move again, di back skata, bikos of di way di wave dey blow am. 42Di sojas kon plan to kill all di prisonas make dem nor for fit swim kon eskape. 43But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land 44and di rest pipol kon follow for back, some whole di wood and odas whole di ship body wey break. Na so all of dem take rish land and nobody die.

目前选定:

Acts 27: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录