Acts 21

21
Paul Go Jerusalem
1Afta wi don leave dem, wi enter ship kon travel go Kos. Di next day, wi go Rhodes and from der, wi kon go Patara. 2Wi si one ship dey cross go Foenicia, so wi kon enter am. 3Afta wi rish Cyprus, wi kon leave der travel go Siria, kom stop for Tyre, bikos di ship won put load down. 4Wi kon go find di disciples wey dey for di town, wen wi si dem, wi stay with dem for seven days. Dem kon tell Paul many times sey make e nor go Jerusalem. 5Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside 6kon tell dem bye-bye and as wi enter ship, dem kon go back to dia house. 7Wi kontinue awa journey from Tyre go rish Ptolemais and wen wi don greet di brodas, wi stay with dem for one day. 8Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am. 9(E get for dotas wey neva marry, wey dey profesai.)
10As wi stay der for some days, one profet wey en name na Agabus kom from Judea. 11E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ” 12Wen wi hear wetin e tok, wi and di pipol wey dey der kon beg Paul sey make e nor go Jerusalem. 13But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.” 14Bikos wi nor fit stop am again, wi kon keep kwayet and only en kon sey, “Wetin God wont make e happen, go happen.”
15Afta dat day, wi prepare kon go Jerusalem. 16Some disciples from Caesaria follow us go, dem kon take us go Mnason house for Cyprus. Dis Mnason dey among di first disciples and wi stay der with am. 17Wen wi rish Jerusalem, di brodas welkom us with happiness. 18Di next day, Paul kon follow us go si James and all di eldas wey dey der. 19Wen Paul don greet dem, e kon start to tok di story about wetin God don do for Gentile pipol thru en ministry. 20Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey praiz God. Den, dem tell am, “Yu si, awa broda, many Jew don bilive and dem still dey obey di law! 21Dem hear sey yu dey tish Jew pipol wey dey stay with Gentile pipol, sey make dem trowey Moses Law; make dem nor sekonsaiz dia shidren again and make dem nor follow awa laws again. 22So, wetin wi go do? Bikos dem go really hear sey yu don kom. 23So make yu do wetin wi won tell yu: For men dey with us here wey make vow; 24take dem follow body make una go do wetin Moses Law tok and make yu pay all di money wey dem spend take shave dia head. Den, evribody go know sey all di story wey dem hear about yu, nor bi true and dem go si sey yu yorsef dey obey di law. 25But for Gentile pipol wey don bilive, wi don rite leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.”
26Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
27Wen di seven days don dey finish, di Jew pipol wey kom from Asia kon si am for di temple, naim dem start wahala and pipol kon gada. Dem seize Paul 28dey shaut sey, “Israel pipol, make una kom o-o! Dis na di man wey dey tish pipol for evriwhere, about tins wey dey against awa pipol, awa law and against dis Temple. Even sef e don take Greek pipol enter inside di temple kon make dis Holy Place dirty.” 29(Bikos dem si Trofimus wey kom from Efesus for di town with am before, so dem kon tink sey, Paul don karry am enter di temple.) 30Di whole town start to shake and all di pipol kon gada. Dem seize Paul, drag am komot from di temple kon klose di door. 31As dem dey try to kill-am, news kon rish di kommanding offisa for di Roman soja wey dey guide di town sey, di whole Jerusalem don skata. 32At wons, e karry plenty sojas and ofisas kon run go where di pipol gada. Wen dem si di kommanding offisa and di sojas, dem kon stop to beat Paul. 33Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do. 34Some pipol among di crowd kon dey tok difren-difren tins and wen di kommanding offisa nor fit know wetin kause di wahala, e kon give orda sey, make dem karry Paul go barrak. 35Wen e rish di step for di temple, di sojas kon karry Paul, bikos of di crowd wey won kill-am. 36So dem follow di sojas for back kon dey shaut, “Kill-am!” 37As dem won karry Paul enter di barrak, e kon ask di kommanding offisa, “I go fit tok to yu first?” Di offisa ansa, “So yu dey hear Greek language? 38So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?” 39Paul ansa, “I bi Jew wey kom from Tarsus wey dey Silisia. I bi citizin for dis town and dem know mi well-well. Abeg allow mi follow di pipol tok.” 40Wen di kommanding offisa allow am, Paul kon stand for di step, wave en hand sey make dem kwayet. Wen evriwhere don kwayet, e kon use Aramaik language follow dem tok.

目前选定:

Acts 21: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录