Acts 18

18
Paul Dey Korint
1Afta dis tins, Paul komot from Atens go Korint. 2For der, e kon si one Jew wey dem dey koll Akwila, wey kom from Pontus and e just kom back from Italy with en wife Priscilla, bikos Klaudius orda sey make all Jew pipol komot from Rome. Paul go meet dem 3and bikos dem dey do di same work, e kon stay with dem dey follow dem work (na tent dem dey make sell). 4E dey tok to both Jew and Greek pipol for di sinagog evry Sabat Day, so dat dem go bilive.
5Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ. 6Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!” 7Den Paul komot for di sinagog go Titus Justus house; di man na Gentile wey dey woship God and en house dey near di sinagog. 8Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem. 9Jesus kon tell Paul for vishon for nite, “Make yu nor kwayet bikos of fear, but make yu open yor mout dey tok, 10I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.” 11So Paul stay der for one year and six monts dey tish di pipol God word.
Paul Face Gallio
12Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat. 13Dem sey, “Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!” 14But just as Paul won start to tok, Gallio kon tell di Jew pipol sey, “If na bikos of one offence or sirious wayo, I for listin to una komplain, 15but since na matter about word, name and una own law, make una go setol am by unasef. I nor go judge all doz kind tins!” 16So e drive dem komot from di judgement seat. 17Dem kon seize Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di judgement seat front. But Gallio do like sey all dis tins nor koncern am.
Paul Go Back To Antiok
18Afta Paul don stay many days for Korint, e kon tell all di brodas bye-bye, den e enter ship go Siria, but Priscilla and Akwila follow am go. For Cenchrea, e kon kut en hair bikos e make vow. 19Wen dem rish Efesus, Paul leave Priscilla and Akwila for der, but en ensef enter di sinagog go follow di Jew pipol tok. 20Wen dem sey make e stay with dem small, e nor gri, 21but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus 22and wen e rish, Caesaria pass go Jerusalem go salot di pipol for di church wey dey der, before e go Antiok. 23Afta e don stay small for der, Paul komot kon travel pass all di aria wey dey Galatian and Frigia, dey enkourage all di disciples.
Apollos Start En Ministry
24E get one Jew man, en name na Apollos and e from Alexandria go Efesus. Apollos sabi tok and e know di Bible well-well. 25Dem don tish am about Jesus and na with high spirit e take dey tok and tish about Jesus Christ, but na only John baptizim e know rish. 26E kon dey tok with boldness for di sinagog, but wen Priscilla and Akwila hear am dey tok, dem koll am go korna kon esplain God word gi-am well-well. 27Wen Apollos one cross go Akaia, di brodas enkourage am kon gi-am leta make e give di disciples, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivers, 28bikos e nor gri with wetin di Jew pipol dey tok for publik and e show dem from di Bible sey na Jesus Christ, bi di Mezaya.

目前选定:

Acts 18: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录