Acts 16
16
Timoti Join Paul And Silas
1Paul kon still go Derbe and Lystra. One disciple wey dem dey koll Timoti dey der. En mama na Jew wey bilive Christ, but en papa, na Greek. 2Di brodas wey dey Lystra and Ikonium dey tok good about am. 3Paul wont make Timoti follow am, so e sekonsaiz am, bikos di Jew pipol wey dey for di aria, know sey en papa na Greek. 4As dem dey go from town to town, dem kon dey pass di message wey di apostles and eldas for Jerusalem send to all di Gentile pipol wey bilive Christ sey, make dem obey. 5So di pipol for di church dey strong more-more for faith and dem kon dey plenty evriday.
Paul Si Masidonia Man For Vishon
6Dem pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia. 7Wen dem rish Mysia, dem kon try to enter inside Bitynia, but Jesus Christ Spirit nor allow dem enter, 8naim dem pass thru Mysia kon face Troas. 9Paul si dis vishon for nite: One man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, “Make yu kom help us for Masidonia!” 10Wen Paul si dis vishon finish, wi kon try to go Masidonia. Wi kon bilive sey God don koll us make wi go prish di Good News to di pipol wey dey der.
Dem Rish Filippi
11Wi travel for wota from Troas and awa ship kon from der go Samotrace and di next day, wi go Neapolis 12and from der, to Filippi wey bi nomba one town for Masidonia, wey Rome dey rule. Wi stay for dis town for some days. 13Wen Sabat Day rish, wi komot from di town go di wotaside, where wi tink sey wi go si where dem for dey pray, naim wi sidan kon start to dey tok to di wimen wey gada for der. 14E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok. 15Afta en and en family don baptize, e kon beg us sey, “If una don asept mi as pesin wey bilive Christ, make una kon stay for my house.” So e beg us until wi gri.
Dem Arrest Paul And Silas
16One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen. 17Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey, “Dis pipol na God savants o-o, dem dey prish to una about how una go take save.” 18E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body. 19But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre. 20Den dem drag dem go meet di judge dem kon sey, “All dis men dey kause wahala for dis town. Dem bi Jew 21and dem dey tish law wey nor bi awa own, since wi bi Rome pipol.”
22All di pipol wey gada for der kon join put mout against dem and di judge dem kon give orda sey, make dem remove Paul and Silas klot komot for dia body and flog dem with heavy stik. 23Afta dem don flog dem well-well, dem put dem for prison kon tell di warda make e guide dem well-well. 24Bikos of dis strong orda, di warda put dem for inside-inside di prison kon hook dia leg with big-big shains.
25Wen mid-nite rish, Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem. 26At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too. Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison, kon luz. 27Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run. 28But Paul shaut, “Make yu nor kill yorsef, all of us still dey for here!” 29Naim di warda sey make dem bring lite and e rush enter inside di prison kon fall for Paul and Silas front dey shake. 30E bring dem kom outside kon ask, “My oga dem, wetin I go do to dey save?” 31Dem ansa am, “Bilive Jesus Christ and yu go save, both yu and all yor family.” 32Den, dem prish God word give en and all di pipol wey dey en house. 33Dat nite, di warda kon wosh all dia sore; den en and en family kon baptize. 34Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God. 35Wen day break, di judge dem kon send sojas sey, “Make una go release doz men.” 36Di warda tell Paul, “Di judge dem don give orda sey make wi free una. So make una kon dey go.” 37But Paul tell di sojas, “Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase, even doh sey wi bi Rome pipol, dem still trow us for prison. Naw, dem won free us from back make pipol nor for know? Wi nor gri! Make dem kom here by demsef kon release us!” 38Di sojas kon ripot wetin Paul tok give di judge dem. Fear katch dem wen dem hear sey Paul and Silas na Rome pipol, 39so dem kon beg dem sey make dem nor vex. Afta dem bring dem kom out, dem kon beg dem well-well sey make dem leave di town. 40Wen dem don komot for prison, dem enter Lydia house and wen dem si di brodas, dem enkourage dem before dem leave di town.
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee