2 Korintians 2
2
God Go Forgive Sinnas
1So I sey I nor go kom visit una, so dat una nor go vex again. 2Bikos if I make una vex, who go make mi dey happy apart from una wey dey vex for mi? 3Na dis make mi rite dis tin give una, so dat wen I kom, I nor go kon dey vex for di pipol wey suppose make mi happy, bikos I know sey if I dey happy, una go dey happy too. 4Na pain for my heart I take rite dis leta give una, nor bi to make una vex, but na to let una know di kind love wey I get for una. 5Naw if anybody don make pesin vex, nor bi only mi e make vex, but na all of una. (I dey tok like dis bikos I nor won too vex for di pesin). 6Di way wey una ponish dis pesin, don rish. 7So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am. 8So make una let am know sey una really love am. 9I rite dis leta give una, so dat I go know weda una dey obey wetin I tell una. 10Wen una forgive pesin for wetin e do, misef go forgi-am. Bikos wen I forgive (if I really nid to forgive), I do am for Christ present, bikos of una, 11so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo. 12Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi, 13my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia.
Di Apostle Ministry
14But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere. 15Bikos wi bi like sweet smell wey Christ offa give God wey dey spread among doz wey dey save and doz wey don lost. 16To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins? 17Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee