1 Korintians 13

13
Wetin Love Mean
1If I dey tok di language wey human being and angels dey tok; 2if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin. 3If I give pipol evritin wey I get kon sey make dem burn mi alive, but I nor love odas, I nor go gain anytin.
4Love dey kind and patient, e nor dey jealous or boast 5or dey proud. Love nor get long-trot or dey vex. E nor dey remember di bad tins wey odas do. 6E nor dey happy with wiked pipol, but e dey happy with di trut. 7Love dey bear evritin and e get faith, hope and patient.
8Love nor dey fail and e go dey forever. Pipol nor go profesai forever and doz wey dey tok with difren-difren language, go stop. For dat time, wi go forget evritin wey wi know. 9Naw, wi nor know evritin and awa profesy nor komplete. 10But one day, wetin dey pafet go kom and wetin nor dey pafet, go vanish. 11Wen wi neva know Christ, wi dey tink and tok like small shidren. But naw wen wi don know am, wi nor dey do like small shidren again. 12Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us. 13And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.

目前选定:

1 Korintians 13: pcm

高亮显示

分享

复制

None

想要在所有设备上保存你的高亮显示吗? 注册或登录