1
Mark 9:23
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
对照
探索 Mark 9:23
2
Mark 9:24
Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”
探索 Mark 9:24
3
Mark 9:28-29
Wen e enter di house, en disciples kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot?” Jesus ansa dem, “Na only with prayer and fasting dis kind one dey take komot.”
探索 Mark 9:28-29
4
Mark 9:50
“Salt good, but if e nor get taste again, how pesin go fit take make am sweet? Make una get salt inside una and make una dey live for peace with each oda.”
探索 Mark 9:50
5
Mark 9:37
“Anybody wey welkom one of dis small pikin bikos of mi, na mi e welkom and anybody wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, but na my Papa wey send mi.”
探索 Mark 9:37
6
Mark 9:41
I tell una true word, anybody wey give yu cup of wota bikos yu dey follow mi, nor go ever luz en reward.
探索 Mark 9:41
7
Mark 9:42
“If anybody make one among dis small pikin wey bilive mi kommit sin, e go betta make dem tie big stone for en neck kon trow am inside river.
探索 Mark 9:42
8
Mark 9:47
If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh
探索 Mark 9:47
主页
圣经
计划
视频