1
Galatians 6:9
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am.
对照
探索 Galatians 6:9
2
Galatians 6:10
So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.
探索 Galatians 6:10
3
Galatians 6:2
Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.
探索 Galatians 6:2
4
Galatians 6:7
Make una nor let anybody deceive una. Nobody go fit deceive God. Anytin wey pesin plant, naim e go reap
探索 Galatians 6:7
5
Galatians 6:8
bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.
探索 Galatians 6:8
6
Galatians 6:1
My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.
探索 Galatians 6:1
7
Galatians 6:3-5
Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef. Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef. Bikos each pesin go karry en own load by ensef.
探索 Galatians 6:3-5
主页
圣经
计划
视频